HIV/AIDS

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

AIDS wey di full nem na Acquired Immunodeficiency Syndrome na one disis wey di vairus HIV de korse.HIV full nem na Human immunodeficiency Virus.Wen HIV fest enta pesin bodi, di pesin fit no show eni sahin or e fit jos get smol fifa or kata.Wen di HIV don enta pesin bodi, e go dey inside bodi dey rest an dey gada pawa wey Oyinbo dey kol Inkubashon piriod.Wen di HIV vairus don gada pawa finish, e go stat to fight di pat of di bodi wey no dey gri mek disis enta di bodi.Afta som time, di HIV vairus go kom dey win an kil dose pat, yeye disis wen no sopoz enta bodi go stat to enta bodi an Tumor sef fit stat too. Wen di HIV vairus don tey inside bodi an dose oda sikness don dey show, we fit tok sey di pesin don get AIDS.Wen di tin don lid to AIDS, di pesin go stat to dey loss bodi fat wey dey inside bodi an e go dey lin. Tins wey fit mek pesin get HIV inklud Sex wey no get proteshon, to dey kolet an pass blood inside bodi, to dey share nidu an from mama to pikin wey stil dey belle. Salava, Wota wey dey komot for bodi ( Sweat) an wota wey dey komot for eye (tears) no fit give pesin HIV.Mek pesin dey du oral sex no fit mek pesin get HIV. If pesin dey du safe sex, no dey kolet an yuz nidu enihow, pesin fit no get HIV.If mama wey get HIV dey yuz di medisine wey dokto sey mek e dey yuz wel, e pikin wey dé belle or wey de giv breast fit no get HIV. HIV dey korse meni wahala for sosieti bikos of di disis an bikos of how pipul no wan dey du tins wit pipul wey get di sikness. Meni pipul biliv tins wey no koret abaut HIV. Som of di lie lie tins wey pipul buliv na sey if pesin jos near pesin wey get HIV e sef go get am. HIV topik don bi big topik for rilijion mata, for ezampul, Katolik chorch tok sey dey no go sopot mek pesin dey yuz kondom bikos of sey e no wan kach HIV. Meni medikal an politika organasashon don tok abaut dis disis meni time an dey don donate plenti moni bikos of di disis sins 1980s. Na anima fest stat to get HIV bifor di disis kom stat to dey kach man an wuman too in West Afrika in di eli to di midu of di 20th senturi.Na for CDC (Centers for Disease Control and Prevention) in USA dey tek fest diskova AIDS in 1981. Dey diskova wetin dey korse AIDS in the eli pat of di dekede. If we kaunt how meni pipul AIDS don kpai from di time wey don diskova di sikness onti 2021, di nomba go don rish 40 million wold wide.For 2021, na 650,000 kpai bikos of AIDS an na abaut 38 million pipul get di disis wold wide. Di nomba of pipul wey get di disis for Easta an Souta Afrika go rish 20.6 million out of di 38 million wey get am wold wide.HIV dey among di disis wey dey di grup of pandemik disis ( disis wey dey evri wie an wey dey kash pipul fas fas) Di United States' National Institutes of Health (NIH) join hand wit Gate Foundation tok sey dey go put 200 million dollars mek dey tek find solushion to AIDS. For now, solutions or vassine neva dey, bot som drug fit hep slow down di disis an pesin wey dey yuz am fit liv norma life.If pesin no yuz di tritmet di pesin fit no liv pass 11 years from di time wey e kash di disis. Two pipul wey don kash di disis bifor no get am again akordin to ripot as dia tori nem na Berlin Patient an London patient.