Gregory Ngaji

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Gregory Ngaji (dey bon am for November 17, 1946) na Naijá politishian an foma memba of Nashional Sinate for Kross Riva North Constituency of Kross Riva Stet from 2003 go rich 2011.

Tori abaut im life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Gregory Nnaji on November 17, 1946. E go skul for Mary Knoll College for Okuku, for Yala for inside kross Riva fom 1962-1965, e kom get one satifikate wey dem dey kol LL.B, fom one big skul wey dem dey kol Univasiti of Nigeria for Nsukka for di year 1977. Gregory Nnaji kom stil get anoda BL satifikate as pesin wey go len how dem dey jorge pipul mata for inside kot. E get dis one fom Nigerian Law School for 1978. Bifo dem chuz am to stand for di pipul for Sinate, im be di oga pata-pata for di Yala Local Government Area and e stil folo saf as pat of di pipul wey dey kontrol dat aria (1994-1995).

How im wok as Sinator[chenj-am | chenj-am for orijin]

Gregory Ngaji kom out mek dem chuz am wen im dey wit di grup wey dem dey kol People's Democratic Party (PDP) an dem chuz am to wok as pesin wey go stand for pipul for govment side for di 5th National Assembly fom 1962-1965. E stand for di kross Riva North Sinatorial District an dem kon stil chuz am again to du dis kind tin again for April 2007. Gregory Nnaji dey wok as pat of di joinbodi wey dey kontrol wota mata, Sayense & teknoloji, how pipul tek dey travu on top wota, medisine for bodi pain mata, to fight pipul wey wan chop govment moni and pipul wey dey wok as pesin wey dey plant food and train animal.

Im dey among di pipul wey sitdowm jorge Mrs Farida Waziri for June 2008 sey mek shi no bi di oga pata-pata for di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC). For April 2009, Gregory Nnaji folo for pipul wey giv moni to sopot sey mek dem stat to du Nigerian Transport Commission to riplase di Nigeria Shippers Council. Wen taim rich for pipul to no how di pipul wey dey stand for dem for govment don waka rjch for half way, one niuzpeppa wey dem dey kol This Day rait sey Ngaji stil giv moni so dat dem go sopot di National Space Research and Development Agency Bill for 2008, and e rili put bodi for any wok wey dem tel am to do even tho sey e no folo for di tin like dat.

for 2008, di National Boundary Commission an di Revenue Allocation Mobilisation and Fiscal Committee kom chenj di pipul wey go dey kontrol wia oil dey for di big Bakassi wota fom kross Riva go rich Akwa Ibom. For July 2009, Gregory Ngaji tok sey "wetin those two group do no follow for law at all and we go do everitin to get our places wey oil dey"