Gjendine Slålien

From Wikipedia

Kaia Gjendine Slålien ( dey bon am 1871 an e kpai 1972) na Norway wuman wey dey hep komot milk from cow an e sabi sing tradishonal muzik. Gjendine muzik dey swit Edvard Greig an e frend-dem we dey lisin to di song. Na in 1891 Edvard Greig an e frend fest go mit Gjendine at Skogadalsbøen wey e dey stey in Vestland. Greig an e frend go pass di road wey mountain full as dem dey go an kom to lisin to e song. Grieg song "Gjendines bådnlåt" de pat of "Opus 66"19 Norwegian Folk Songs". As Gjendine dey grow old, na so pipul dey no am more more. Infat, Kween Wilhelmina of di Netherland sef visit am. Wen Gjendine rish 90 years, dey kol am to kom Bergen Festival an for di festival e mit King Olav.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Gjendebu wey de Bøverdai, Lom Municipality dey bon Kaia Gjendine Slålien. E na gel-pikin of Eirik A. Slålien (bon in 1829 an kpai in 1915) an e wife Anne Slålien ( e wife nem bifor marej na Syversdatter.Dey bon e wife 1837 an e kpai 1924). Gjendine papa na farma. Dey give am Gjendine bikos of dat is di nem of e famili land wey dey tek dey du agri-kolsho. Wen Gjendine dey 10 days old, Priest Honoratus Balling baptase am. Na Halvor Olsen Slålien e mari.Halvor Olsen Slålien na farma an pesin wey dey show pipul road as dem dey waka araund for di plaze. E hosband sabi play di violin veri wel wel. Na Gjendine mama an e gra-pa tish am meni of di song wey e sabi sing.

How e tek wok as singa[chenj-am | chenj-am for orijin]

As a young gel, Gjendine dey stet wit e papa for Gjendebu dorin di dry sisin an leta e go go di mountain side by e sef or folo pipul wey get farms for Skogadalsbøen. Na wen e bi 20 years old in 1891 e mit Edvard Grieg an e frend wey dey jos de waka abaut for di mountain side. Grieg frend-dem na Frants Beyer an di Holland komposa Julius Röntgen.