Ghostlore

From Wikipedia

Ghostlore na tradishonal bilif an kolsho wey plenti pipu get abaut ghosts an hau e dey sho. Ghostlore don dey for insaid wetin plenti pipu kolsho for di wold. Dem tok abaut am as wen pesin wey don kpai dey sho, ghostlore stan as wetin plenti pipu bilif, an e don tay for pipu histri.

Di wod "ghost" get plenti meaning bikos so meni pipu don uze religion, kolsho, an histri tok di meaning. Plenti of di meaning dey konet am to spirit, an hol di tori dey bring fear fear for pipu mind.

Histri[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di fest tori abaut ghost wey dey porshu for hauz wey dey for rekod na di one wey Mostellaria, wey no abaut kolsho rait, wey bi sey im sef look fom one ghost tori wey don los wey im nem na Phasma wey Athenian poet Philemon rait. Afta plenti century pas, fom wetin Pliny di younger rait, wey bi di sekond tin wey old pas for hau spirit dey porshu pesin. Hau ghostlore tek stat na as pipu biliv insaid spirit wey no kpai wey stil dey muv up an down. Plenti old kolsho, lik Di Egyptians an Greeks, hol bliv insaid spirit wey no kpai. Di Greeks, for ezampu bliv sey di spirit dey muv afta life an dem dey holways jorj dem leta, if e du beta di spirit go njoi life, but if e du bad e dey sarf jorjmet.

For midu age, ghost tori na abaut spirit wey no rest, wey no ci peace for aftalaif. Dia bliv bi sey this spirit na pipu wey dem du bad for wen dem dey dis laif or dem kpai in a bad way. Dem dey uze dis tori tich pipu lesson, wit ghost stan as wornin for pipu wey wan du bad an di risot for sin.

Ghostlore don dey popula for insaid pipu wey dem jus bon an pipu wey sabi buk an travu wel wel, na science pipu dey chalenj di bilif of aftalaif livin.

In di 19th an 20th centuries, pipu lik to dey tok an hie spirit tins, wit plenti pipu wey bliv sey ghost dey lif an pesin fit tok wit pesin wey kpai. Na dis one kon mek ghost tori plenti, an meni pipu lik tok abaut ghost an hau e dey porshu pipu.

Todey, ghostlore na popula tin for film, buk, an oda plenti sho tins. Wit plenti science pipu tok abaut ghost an hau e no dey posibu to dey porshu pesin, meni pipu stil lik to dey pipu wey kpai spirit stil dey an dem dey lik tok di tori for pipu.

Difren kain of ghost[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ghost na kommon tin insaid plenti kolsho an tradishon for di world, an dey dey difren kain. Na som of di ghost wey dey for ghostlore:

. Vengeful ghost: Dis na ghost wey d kpai dem wit wikednez an won kon faight bak. Dem bliv sey dem pesin kil dem, soilder wey kpai Wen dey dey war, abi pipu wey dem don du bad for insaid life.

. Friendly ghost: Dem difren fom Vengeful ghost bikos dem dey holways hep pipu wey dey life. Dem bliv sey na dis kain ghost dey luk afta dia famili, or dey luk afta di pipu wey dem lov.

. Poltergeist: poltergeist na ghost wey dem bliv sey dey holways mek nois. Dem bliv sey poltergeist spirit dey muv tins for hauz.

. Ghost of ancestors: Insaid plenti kolsho dem bliv sey spirit dey holways dey afet dia pipu wey stil dey liv. Dis ghost dem dey holways giv dem skrifais or praya so dat dem go kontinue dey hep dia famili.

. Ghost of Children: Dis spirit of Ghost of Children na wetin most kolsho bliv sey na ghost wey get pawa wel wel. Som taims, dem dey ci am as ghost wey no sabi enitin wey dey kari gud luck, but dem dey run for oda spirit bikos dem bliv sey e wan kon get pipu wey du am bad.

.Ghostly Animal: Insaid som kolsho, dem bliv sey animal sef fit bi ghost. Dis kain animal na animal wey kommuniti sabi an wey dem dey pley wit.