George Oguntade

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

George Oguntade (CFR CON) (dem bon am for March 10, 1940) na ritaya Naijá lorya wey saf jostis for supreme court of Naijá fom May 19, 2004 to May 10, 2010 an na Naijá Hi Komisiona to di United Kingdom.

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Oguntade for Epe, Lagos stet an na dia e finish e pamari skul. E go Holborn college of law for 1964. Afta e rid law for koleg, e go Nigeria Law School for 1965 an dey kol am to Nigeria bar in January 15, 1966.

How im tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Oguntade kontinu to du e law Karia as kot klark for Di Hi kot of jostis Ibadan an for September 1980, dey chuz am as jorge for Lagos Hi kot afta e don dey for Lagos bar for 14 years. Bitwin September 1987 go rich May 2004, George saf as presidin jostis for meni stet kot of Appeals for Naijá ontil dey chuz am as jostis for Supreme Court of Nigeria for May 19, 2004. Sins im don rich di 70 year old wey bi Di age wey pesin dey ritaya, George ritaya fom Supreme Court Bench for May 10, 2010. For September 2015 dem chuz George as Chancellor of di Lagos state University Governing council by Akinwumi Ambode. George Oguntade kom stat duti for Hi Komisiona of di Federal Republic of Nigeria for di United Kingdom for 9th October 2017.

Di Awod wey dem giv am[chenj-am | chenj-am for orijin]

Commander of di order of di Niger 2010 Commander of di Federal Republic 2010