Genoveva Umeh
Genoveva Kenechukwu Umeh (bon 8 May 1995) wey plenti pipu sabi as Genoveva Umeh na British–Nigerian Aktres. Na shi win Best Sopotin Aktres for AMVCA insaid May 2024 bikos of di kain way shi akt insaid Prime Video Orijina wey bi "Breath of Life". Im nem dey insaid pipu wey fit win Best Aktres in drama insaid Afrika Magik Viewers Choice Awods 2022 bikos of di wey shi tek akt for 'A Tune Away'. Pipu stil like am bikos of hau shi tek du fest Netflix orijina series 'Blood Sisters' an yung adult series 'Far From Home'. One of di fim wey shi akt na 'One Lagos Night', 2019. Shi akt as Shidara for Episode 4 of Showmax's Orijina Drama series 'Crime and Justice Lagos' 2022. Insaid 2024, shi win Best Sopoting aktres for di 2024 AMVCA for di rol shi akt in Breath of Life (2023 fim).
Im pasonal life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Genoveva Umeh gro for Naija an United Stet. Dem bon am for Enugu, Enugu Stet, Nigeria on 8 May 1995 to computa engineer, Gaius Umeh an Nurse Ifeoma Umeh. Shi liv insaid Enugu ontil shi rish 12 years old an shi kolet primari edukashon certificate fom Command Children's School, Enugu.
Genoveva du im fest year of sekondri edukashon for Command Day Sekondri Skul, Enugu. E leta komot for di skul go United Kingdom in 2006. Shi kon finish im sekondri an A Level edukashon at St Marys C of E High Skul in London, United Kingdom.
Genoveva don lik to dey akt sins e dey smol for sekondri skul an kon stil go for am as part taim drama skul, Identity School of Acting, UK in 2012. Shi du som smol pley for Hammersmith Theatre wey dey London for summer holide. Shi kon go get digre in LLB law fom di University of Surrey, England, an e finish wit honors.
Hau shi tek wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Genoveva muv go Lagos, Nigeria in 2018 to tek du im aktin wok. Shi rait an parfom wuman stej pley, HOME, wey dem pafom for Fringe Festival insaid Legos, Nigeria an afta one year for Bloemfontein, South Africa. Shi pafom as Lami insaid Rue14 studio stej pley, 'High' wey dem du to hep yung pipu sabi hau to dey uze drug in December 2018 an 2019.
Genoveva fest lead rol na insaid A Tune Away 2020 fim, wey mek im nem dey insaid pipu wey fit win Best Aktres for di 2022 Afrika Majik Viewers Choice.
Som of im wok
[chenj-am | chenj-am for orijin]Film/Television
[chenj-am | chenj-am for orijin]Year | Title | Role | Ref |
---|---|---|---|
2019 | Blameless | Ezinne | |
Love is War | Young Lady | ||
2020 | Survivor's Guilt | Ayobami | |
The Crazy Wife | Alicia | ||
2021 | Reflections | Kenena | |
Country Hard | Funmi | ||
Focus | Jess | ||
All Good Things | Funmi | ||
Lizard | Khafilat | ||
The Griot | Associate producer | ||
One Lagos Night | Anita | ||
Temi's Diary | Omolara | ||
2022 | Crime & Justice | Shindara | |
Breath of Life | Anna | ||
Blood Sisters | Timeyin | > | |
Far From Home | Zina | ||
IJO: A Love Story | Molara | ||
A Tune Away | Anita | ||
2023 | Shuga (Season 5) | Chika | |
2023 | A Tribe Called Judah | Testimony |
Theatre
[chenj-am | chenj-am for orijin]Year | Title | Role | Short Notes |
---|---|---|---|
2016 | Mind Body Soul | Keisha | T.D MOYO (Lyric Hammersmith London) |
2018 | High On | Lami Philips | Kenneth Uphoho (Rue 14 Studios) |
Home | Genoveva Umeh | Ibukun Fasunhan | |
Dodo | Amarachi | T.D MOYO |
Awards and nominations
[chenj-am | chenj-am for orijin]Year | Award | Category | Result | Ref |
---|---|---|---|---|
2022 | Africa Magic Viewers Choice Award | Best Actress in a Drama | Nominated | |
2023 | The Future Awards Africa | Prize for Acting | Nominated | |
2024 | Africa Magic Viewers' Choice Awards | Best Supporting Actress | Won |