Genevieve Massignon

From Wikipedia

Genevieve Massignon (Paris, 27 April 1921-6 June 1966) na one Frensh linguist, ethnologist, musicologist an historian wey stodi Acadeian spish, an dialects an linguisticskomuniti dem for Brittany, for West of Frans an for Corsca.Shi poblish plenti impotant wok dem bez on dis risash.

Tori abaut E Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Massignon kolet e License-es-lettres for 1941.For 1945( afta sekond Wold War),shi kontiniu Jaques Pignon(pesin wey die bifor time)wok,to dey pripe di CNRS for one linguistic atlas'for di senta- West of France,an shi fokos on di dipatment of Vendee,Deux-Servres,Vienne,Charente,an Charete-Maritime:di Portevin-Saintongeais dialectarca.Bifor shi die shi don finish di sovey wok wey Brigitte Horil go poblish an di nem go bi:Linguistic and Ethnographic AtlasPoitau,Aunis,Saintonge,Angoumois.Na dis atlas dem yuz tek do di dialectometric analysis of di dialect wey Liliane Jaqueneau do. Bikos shi get intres for di wok wey e eda broda Yve-Massignon,wey bi human geographer an dey Liv for Madawska,Canada do, shi stat to dey do risash ontop di Acadain French komuniti Yve-Massignon stodi loka French-Canada komuniti bifor e die for 20 yias old. Dem poblish di risash wok wey e do an nem as,In Canada,the Upper Valley of Saint-Jean(Madawaska)and the future of Franco-AmericanFor 1946, Massignon get skolaship from French Ministri of Foreign Affairs'Cultural Relationsdipatment an dis kom mek fit travu go Canadian Maritime provincedem an di Mississippi Delta rijon go kolet traditional Acadian folklore an stori demand shi stil yuz dat time survey di loka dialect dem.Na dis investigeshon shi tek stat e PhD,Les parlers francais d'Acadie. For 1966,shi sopos go di Franco -Acadian Festivities for Belle-Ile-en-Mer to mak di bicenennial of di Acadiansetument dem on top di Island.Na heartatak juz kill am as e remen smol mek dem stat di festival. Apart from di linguistic wok dem wey shi do, Massignon kolet tradishonal stori an muzik dem from komuniti dem wey dey for Acadia, Brittany, Corsica an di West of France. BNF don poblish list an rekod of e buk dem. FrenchIslamologist Louis Massignon, shi get two broda dem, Yves an Daniel Massignon.

Genevieve Massignon Wok Dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

Genevieve Massignon famili donet e wok dem giv BNF for 1985.

E Honor Dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

Medal of di Academy of Letters of Quebec(1963).Na shi bi di firstforeigner wey kolet di medal.

Som of E Wok Dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Genevieve Massignon, Les peelers francais d'Acadre:enquette linguistque, Paris:C Klinscksieck.
  • Genevieve Massignon, Brigitte Horiot, Linguistic and Ethnot Atlas of West:Poitou,Aunis,Saintonge,Angoumois,3volumes,1971-1983
  • Genevieve Massignon, De bouche a orilles Le cante populaire francais, Begee-Levrault, coll Territories, 1983
  • Genevieve Massignon, Contes de l'Ouest Briere, Vendee, Angoumois, editions Erasme, Paris, 1954