Gboyega Oyetola

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Adegboyega Isiaka Oyetola ( Dem bon am for September 29, 1954) na Naijá politishian an Di gofnor of Osun Stet in Naijá.Na for Iragbiji, Boripe Lokal Govament Aria for Osun Stet e tek kom fom.Oyetola bi di gofnor of Osun Stet afta e win di September 22, 2018 eleshon onda di pati All Progressives Congress(APC).E bi foma Shif of Staff for Rauf Aregbesola wey bi gofnor bifor e kom bikom gofnor tu.

Tori of e life an skul wey e go[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for September 29, 1954 in Iragbiji, inside Boripe Lokal Govament Aria of Osun Stet dey tek bon Adegboyega Isiaka Oyetola.E du e sekondiri skul Ifeoluwa Grammar School, Osogbo in 1972. Afta e sekondiri skul, Oyetola go rid Insurance for Unilag ( University of Lagos) an kolet Bachelor of Science satifikat (Bsc) in 1978. Na for Potiskum, Yobe Stet Oyetola tekbdu e Youth Korpa(NYSC), an na ticha wok for Staff Training Centre e du fom 1978 to 1979. Oyetola get im Masta(Master of Business Administration MBA) fom Unilag (University of Lagos) in 1990.Oyetola dey inside Associate Member, Chartered Insurance Institute for London and Nigeria an Member of Nigeria Institute of Management (NIM).


How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Adegboyega Isiaka Oyetola join Leadway Assurance Company Limited as Aria Manija in 1980 an e wok for dia til e find anoda wok for in 1987 as Underwriting Manija for him work there till 1987 when him move to Crusader Insurance Company Limited fom 1987 to 1990. Oyetola Join Alliance and General Insurance as Teknika Kontrola an e wok for one year.In 1999, Oyetola stat e own kompini Silvertrust Insurance Brokers Limited.E bi di M.D of im kompini til 2011 wen dey pick am as Shif of Staff to Osun Stet Gofnor, Rauf Aregbesola. Oyetola don bin saf as Exeutive Vice Chairman, Paragon Group of Companies bitwin 2005 go rich 2011. E don also saf Chairman of Ebony Properties Limited. Oyetola bi di dareto of Him be Director for Pyramid Securities Limited, ontil 2011.

Political career[chenj-am | chenj-am for orijin]

Oyetola na memba of di Alliance for Democracy (AD) an na dat parti e dey til di parti kom chenj Action Congress (AC), Action Congress of Nigeria (ACN) an finali All Progressives Congress (APC). For July 2018, e bin fight for di All Progressives Congress (APC) Governorship primaries with Osun Stet House of Representatives deputi Spika Yusuf Lasun, Spika of di Osun House of Assembly Nojeem Salaam, Dr Samuel Ibiyemi; Publisher Nigerian NewsDirect Newspapers, Adelere Oriolowo, Moshood Adeoti plus many others for the September 22, 2018 gubernatorial election in Osun state. Him win the primaries come follow go win the election proper after him defeat Ademola Adeleke of People's Democratic Party(PDP). Dem do swear in for am as governor on November 27, 2018.


Personal Life

Gboyega Oyetola dey happily married to Alhaja Kafayat Oyetola and the marriage dey blessed with children. Kafayat na him be the founder plus President of Ilerioluwa Development Initiative,wey be NGO wey dey assist less privileged women and children for Nigeria.