Gbenro Ajibade

From Wikipedia

Gbenro Ajibade (bon Gbenro Emmanuel Ajibade;December 8) na Naijá aktor, model, an pesin wey dey du tok-tok for sho.

Tori abaut im life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Gbenro go Makurdi International School an leta Mount Saint Gabriels Secondary School. Gbenro rid Biology for Benue Stet Univasiti. Gbenro dey popula for di television sho wey di nem na Tinsel. Gbenro also dey for di fim Gbomo Gbomo Express an The Wages. Gbenro bi di most outstadin aktor/model for year 2011 wen Model Achiever Awod do there Awad Serimoni for 2011.

Pasona life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Gbenro na hosband to aktres Osas Ighodaro, an dem bon one gel kol Azariah Tiwatope Osarugue Ajibade. Kata kata enta di marej for 2019 afta four years wey dem mari.

Fim wey Gbenro dey inside[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Gbomo Gbomo Express (2015)
  • 30's (2015)
  • The Wages (2013)
  • Twisted Thorne (2011)
  • Tinsel (2008- til now)