Galit Hasan-Rokem

From Wikipedia

Galit Hasan-Rokem (dem bon for 29 August 1945) na di Max and Margarethe Grunwald Profeso for di Mandil Institute of Jewish Studies for di Hebrew Yunifasi of Jerusalem.

Hasan-Rokem don rait meni buk-dem an e even join-bodi wit Wiley-Blackwell tek rait one buk wey dem kol Companion to folklore(2012). Hasan-Rokem put mind wel-wel risash ontop provab dem,folklore an Midul East pipul Kolsho an difren-difren kind of folklore an tok dem.E even dey poblish poem an e sabi translet poem dem , an Hasan-Rokem even dey sopot pipul wey dey fight for Palestine pipul right dem. One Nius-Pepa wey dem kol The Jerusalem Post tok say Hasan-Rokem sabi big big pesin among di pipul wey dey rait folklore.

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Galit Hasan-Rokem for 1945 for Helsinki.E papa an mama dem kom from Finland. Hasan-Rokem go Helsink Jewish day skul from 1952 go rish 1957. For 1957, wen e stil bi 12 year old, Hasan-Rokem folo e papa an mama travul go Isreal. Afta eb graduat komot for high Skul, Hasan-Rokem go du e komposri militri savis an stat skul for diHebrew Yunifasiti of Jerusalem an as e stil dey dia dey stodi for e digri, e join-bodi du one program of di Dipatment of Finnishan Comparative folklore for Yunifasiti of Finland. Wen Hasan-Rokem dey dia,Profeso MattiKuusi an Lauri Honko dem tish an dis kom mek an get plenti intre to tek stodi as folklorist. Shi kolet e doctorate for di Hebrew Yunifasiti of Jerusalem for 1978, an na Profeso Dov Noy dey tish am. Na 1984 shi ton to Profeso of folklore for di Hebrew Yunifasiti of Jerusalem.

Hau Shi Wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Shi do risash ontop provab dem,folklore an Kolsho of pipul of di Midul East plus difren-difren folklore dem an esplaneshon dem an one folklore wey dem kol rabbiniclitresho. Shi don do plenti wok dem ontop Is real pipul provab dem an Georgian Jew for Isreal. Hasan-Rokem sho wel-wel for e wok say shi sopot wuman dem. Meni pipul sef tok abaut hau Shi dey sopot wuman for inside all e wok espeshali pipul wey dey rait buk dem. Shi even don poblish Meni of e buk an wok dem for eight difren-difren langwej dem.

Oda tins wey Shi do[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Hasan-Rokem stat one projet wey dem dey yuz tek arenj difren-difren provab dem for Hebrew Yunifasiti of Jerusalem.