Funke Akindele
Akindele-Bello Olufunke Ayotunde (Dem Bon am for August 24, 1977)[1] [2]wey pipu no as Funke Akindele or Jenifa na Naijá aktress an fim meka. Akindele stat to dey akt inside fim in 1998 for one Televishion sho wey vet di nem I Need to Know. Di T.V sho stat in 1998 go rich 2002, an 2009.Akindele don kolet Africa Movie Academy Award for Best Actress in a Lidin Rol.Pipu sabi am wel wel for di wey e akt forJenifa wey dey tek dey kol am Jenifa.Omo Ghetto na anoda fim wey Akindele akt wey mek pipul dey kol am omo Ghetto.
Early life and education
[chenj-am | chenj-am for orijin]Akindele wey dem bon for 24 August 1977 for Ikorodu, Lagos State, Nigeria.[3] She be Yoruba woman. She be di second pikin out of for children (thri girls and one boy). Her mama na medical doctor, while her papa na retired skul principal.
na Grace Children's School for Gbagada, Lagos State. She get Ordinary National Diploma (OND) for mass communication from former Ogun State Polytechnic, wey dem now dey cal Moshood Abiola Polytechnic.
Later, she come get law degree from University of Lagos.[4]
Politikal karia
[chenj-am | chenj-am for orijin]Akindele wey dem nominate to be di Lagos deputy governorship candidate under di Peoples Democratic Party for 2023 elections. for her nomination, Abdul-Azeez Olajide Adediran talk say di actress add more value to hin candidacy for 2023 general elections. Akindele konfirm her deputy governorship candidacy, she talk say she go put her acting karier on hold.