Frederick Fasehun

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Frederick Isiotan Fasehun (Dem bon am for September 21, 1935 an e dai for December 1, 2018) na Naijá pesin wey bi medikal doktor.E get hotel an e bi oga for Oodua Peoples Congress (OPC).

Tori about di skul wey e go[chenj-am | chenj-am for orijin]

E rid science for Blackburn College an kontinu im skul matta for Aberdeen University College of Medicine.Fasehun stil go skul for Liverpool Postgraduate School an afta dis one e kom stil du Fellowship or trainee for Royal College of Surgeons. For 1976, e go stodi how China pipul dey yuz nidu an pin dey trit pipul ( Acupuncture) for China. Na World Health Organizashon an United Nations Development Scholarship Program pai for evriitin dia.

How e tek wok an join politiks[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 1977, Fasehun stat one smol grup for pipul wey dey du Acupuncture for Lagos University Teaching Hospital. E stop dis one for 1978 an kwik kwik stat Besthope Hospital and Acupuncture Centre for Lagos. E get one taim wey di Acupuncture get one awod as di fest for di hol Afriks wey dey du dis tin wey China pipul dey du. OPC na one yoruba grup wey dem fom to mek wetin Chief Moshood Kashimawo Olawale Abiola tok bikos im bi yoruba pesin wey win di elekshion to bi di presido for Naijá wey dem du for June 12, 1993 bot dem skata am as dis one no mek Abiola fit bi Presido. Dem put Faseun for prizin for 19 months from December 1996 to June 1998 for di taim wey Sani Abacha bi di hami Presido in Naija, dis one na 18 days afta Abacha don die E dai for di ward of di hospital wey dem dey trit pipu wey dia sickness bad wel-wel for insaid Lagos State University Teaching Hospital for Ikeja inside Legos.

How im take dai[chenj-am | chenj-am for orijin]

E dai on December 1, 2018.