Francisca Oboh-Ikuenobe

From Wikipedia

Francisca Oboh Ikuenobi e dey stodi hau to kontrol water an hau di earth go beta, na fom Ubiaja in Esan South East lokal govmet of Edo noStet|State Shi sabi hau plant dey gro an wetin dey mek am no gro, an na professor of Geology in Department of Geosciences an Geological an petroleum Engineering, shi bi Associate Dean of Academic Affairs in College of Engineering and Computing, Missouri University of Science and Technology.

Hau e tek stat wok an skol[chenj-am | chenj-am for orijin]

Oboh-Ikuenobi go Gorretti Girls Grammar School Benin City, Nigeria. Shi get fest klas BSc in geology in 1983. Afta dat one shi wok as production geologist for Shell Production Development Company of Nigeria in Lagos, an pesin wey dey stodi wota an dust wit Shell for dia Laboratory in Warri Delta State, bifor e go bak to skul for im MSc in applied geology in 1987, fom Univasiti of Ife Nigeria (wey Kon bi Obafemi Awolowo Univasiti now). Afta shi kolet MSc shi dey hep lecturer for Ife Univasiti. Dem giv am Commonwealth Scholarship Commission awod bikos of hau shi tek wok for Department of Health Sciences, Univasiti of Cambridge ( New Hall, nau Murray Edwards College), wey dem giv am di awod for 1991 wit im thesis 'Palaeoenvironmental Reconstruction of di E2.0 Reservior in di Kolo Creed field, Niger Delta (Nigeria)', shi join Missouri S&T, afta dat one Department of Geology an Geoohysics in 1991 as person wey dey hep profesor in geology.

Hau e tek du ofis wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

In 1997 Oboh- Ikuenobe bi di associate profesor of geology, in 2005 full Professor an oga for program in geology an geophysics fom 2006 to 2014. Na shi bi dey as chair persin for smol tim for department fom January 2015 to July 2017, na shi bi associate dean for academic wok in di college of Engineering an Computing an na shi don wok for Shipboard Sedimenlogist on di Ocean Drilling program (Leg 159 Eastern Equitorial Atlantic Transform Margin) January to February 1995. Insaid som ofis shi bi president, president an foma president of di AASP (Di Palynological Society), fom 2010 to 2013, memba for Geological Society of America.Shi dey for insaid som pipu wey gada dey stodi hau dey earth dey chenj fom 2012 to 2015, na director for Association for women wey dey stodi hau earth dey chenj, shi e dey insaid pipu wey dey chek wetin oda pipul rait for di Journal of Africa Earth Science sins 2019. In 2010 an 2011 shi bi wok shop oga for 'On Cutting Edge', na wetin dem plan to dey uze gada an tok abaut earth mata wit memba wey dey stodi hau d earth dey chenj, wey National Association of Geoscience Teachers sopot an National Science Foundation sef uze moni sopot dem, sins 2013 shi bi memba of International Geoscience programme (IGCP).