Francis Uzoho

From Wikipedia

Francis Odinaka Uzoho (dey bon am 28 October 1998) na Naija go-kipa wey dey kip for Omonia klub wey de Cyprus. Uzoho stil dey kip for Naija nashonal tim.

How e tek kip for klub[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dey bon Uzoho for Nwangele. Wen Uzoho bi 14 years old in 2013, e join Aspire Akademi wey de Senegal.

Wen e bi 12 year old, Uzoho fest dey play futbol as strika, but e leta start to kip bikos pipo tok sey e no fast an e too slow.

In 2016, Uzoho kip wel wel for one kompetishon wey dey do for Barcelona an dis one mek Deportivo de La Coruña klub sahin am for dia smol pikin-dem tim .

Bikos Deportivo de La Coruña no fit give am kontrat for dat e age, Uzoho nid to wait till January 2017 to get kontrat with di klub. E kom start to do trenin with Deportivo fest tim. Uzoho play e sinior profeshonal game for Deportivo on 10 September for di game wey hapun in Segunda Division B with Real Madrid Castilla. Deportivo win di game 3-0.

Uzoho play e fest La Liga game on 15 October 2017. Di match na against SD Eibar an e finish 0-0.

Uzoho na di yongest eva forin go-kipa to kip in La Liga at 18 years an 352 days. Uzoho stil bi di sekod yongest eva futbol playa to show inside ligi wen La Liga ligi don rish dat stage. Na Real Madrid playa Achraf Hakimi bi di fest pesin to du am.

On 24 August 2018, Uzoho agri to sahin anoda kontrat to yuz three years with Deportivo. Afta di kontrat, e go loan to Segunda División side Elche CF for one year.

For February 2019, e go loan for Anorthosis Famagusta wey de Cyprus for one year. E go this loan bikos Uzoho wan mek Naija Koch see-am dey kip for klub so dat e go fit dey kip wen dey wan chuz kipa for 2019 Afrika Kup of Neshon.

Afta wey Uzoho kip e fest match for Anorthosis Famagusta, wahala kom de for e health satifiket. Dem remuv 9 point from di klub point but dey go kot go komplain. Di kot no grie for di klub but dem no ban Uzoho for di one match an €1000 moni wey dey plan to kolet again.

For July 2019, Uzoho riton to Cyprus on loan wen e agrie to kip for Omonia. Uzoho no kip too kip for Omonia bikos e get one sirios injuri wen e dey kip for Naija Nashonal tim. Uzoho go sahin for APOEL to yuz three years kip for dem but na onli one year e yuz bifor di kontrat skatta. Wen e rimen one day mek transfa klose, Uzoho kwik-kwik sahin 3 years kontrat with Omonia. E leta sahin anoda one wey go mek am dey Omonia till 2027.

For di game wey e kip for Omonia wen dey play Manchester United for Old Trafford on 13 October 2022, pipo praise Uzoho wel wel bikos e kip wel. Di game finish 1-0 as Manchester United win di game but na 12 save e do for dat game. E nem de di katigori of playa of di wik an save of the day awod.

For March 2023, na Uzoho win di Naija Go-kipa of the year awod wey Nigeria Pitch Awards arenj.

Even sey Uzoho na sekod kippa to Omonia go-kipa, e folo join win Cypriot Kup wey Omonia win in 2022 an 2023.

How e tek kip for kontri[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen e bi 14 years old, Uzoho folo join Naija onda-17 wey play di 2013 FIFA U-17 Wold Kup. Na e bi di sekod kipa to Dele Alampasu.

Uzoho on 14 November 2017 kip for Naija supa eagle wen dem komot Daniel Akpeyi for am to kip in di frendli game wey Naija play with Argentina. Naija Tim win di game 4-2.

Uzoho nem de di Naija 23- man list wey go di 2018 FIFA Wold Kup wey hapun for Russia. Na Uzoho kip di three game wey we play for Russia. Bikos of injuri wey e get for November 2018, e no fit kip for nashonal tim dat time. Uzoho nem de di Tim wey go 2019 Afrika Kup of Neshon. An na e kip wen Naija play with Tunisia wen dem wan chuz di Tim wey go Kari nomba 3 for di kompetishon. Naija win di game.

Uzoho Kari big injuri in October 2019 wen e dey kip for Naija for di frendli game wey Naija play with Brazil. E du opureshon for di injuri in November 2019.

Club =[chenj-am | chenj-am for orijin]

Templet:Updated[1]

Appearances and goals by club, season and competition
Club Season League National cupTemplet:Efn Europe Total
Division Apps Goals Apps Goals Apps Goals Apps Goals
Deportivo B 2017–18 Segunda División B 26 0 26 0
Deportivo La Coruña 2017–18 La Liga 2 0 0 0 2 0
Elche (loan) 2018–19 Segunda División 7 0 1 0 8 0
Anorthosis (loan) 2018–19 Cypriot First Division 3 0 0 0 0 0 3 0
Omonia (loan) 2019–20 Cypriot First Division 5 0 0 0 5 0
APOEL 2020–21 Cypriot First Division 18 0 6 0 0 0 24 0
2021–22 1 0 0 0 1 0
Total 19 0 6 0 0 0 25 0
Omonia 2021–22 Cypriot First Division 9 0 2 0 4Templet:Efn 0 15 0
2022–23 18 0 1 0 4Templet:Efn 0 23 0
2023–24 0 0 0 0 0 0 0 0
Total 27 0 3 0 8 0 38 0
Career total 89 0 10 0 8 0 107 0

Templet:Notelist

  1. Point go mistek: Invalid <ref> tag; no text was provided for refs named soccerwayprof