Françoise Robin

From Wikipedia
Françoise Robin
pesin
Man abi wumanwuman Chenj-am
Kontri wey e kom fromFrance Chenj-am
Nem for lokal langwejFrançoise Robin Chenj-am
Fest nemFrançoise Chenj-am
Famili nemRobin Chenj-am
Wen dem bon am1968 Chenj-am
Langwej wey e fit tok, rait abi yuz hand tokFrench Chenj-am
Wok wey e dey ducollector of fairy tales, Tibetologist Chenj-am
Doctoral advisorHeather Stoddard Chenj-am

Françoise Robin ( dey bon am in 1968) na Tibet professor wey dey stodi Tibetan at Paris' Nashonal Institute of Oriental Langwej (NALCO). For NALCO, e na espat in di langwej, sinima, an litireshon of Tibet. Na Robin stil bi di general seketri of di intanashonal Hasosiashon for Tibetan Stodis.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

E go don pass ova twenty times wey Robin don travul go di Himalayan rijion an Tibet. E yuz three month in Nepal in 1993. Bikos of e risach, Robin stey for ten-month in Tibet in the year 1994. In 1999, Robin get e DEA from INALCO. Na Heather Stoddard supavise di Ph.D pepa wey Robin du in 2003. Di nem of Robin pepa wey e rait for e Ph.D na:"La littérature de fiction d’expression tibétaine au Tibet depuis 1950 : enjeux identitaires" ( "Fiction Literature of Tibetan Expression in Tibet after 1950: Identity Issues").

Leta, Robin bikom a professor at INALCO. Na Robin bi di daretor of di Institute of Tibetan Stodis at the College de France from 2009 to 2015). Na e dey kontro di Tibetan divishon of INALCO sins 2011. Robin stil bi di daretor of INALCO Dipatmet of Southeast Asia, Upper Asia an di Pasific from 2013 to 2014.

Na in 2002 Robin bi a memba of di Société Asiatique an in 2007 till 2010, e bikom a memba of di Hassosiashon for Asia Stodis. E stil enta as memba of di grup from 2017. Robin de among di pipul wey form SFEMT ( The French Society for Study of the Tibetan World) in 2012 an e wok as dia presidor onti 2016. Afta 2016, Robin wok as di grup vais-presidor. Robin still bikom pat of administrashon kansu of di Intanashonal Hassosiashon for Tibetan Stodis in 2016. Na e bi di general seketri sins 2019. Robin na hassosiate memba of di "Research Centre for East Asian Civilizations (CRCAO) at di French Nashonal Senta for Sayentifik Risach