First Consultant Hospital

From Wikipedia

First Consultant Hospital (Pipul no am as First Consultant Medical Centre) na pravate hospitu for Legos. E dey for St. Gregory's College Road for Obalende, wey dey near Legos Island, for Legos Stet. Di hospitu dey popula wel wel in 2014 as di hospitu wey dem tek Ebola virus disis pashient Patrick Sawyer go trit wen e rich Legos.Sawyer leta dai for di hospitu for July 24.

For August 19, niuz kari am sey di dokto wey trit Sawyer for di hospitu, Ameyo Adadevoh, don dai of Ebola disis. Afta Adadevoh dai, dem prais am sey na im stop Sawyer mek e no Liv di hospitu wey kom mek Ebola no tu kach meni pipul in Naijá.