Femi Branch
Femi Branch (wey dem bon for 14 May 1970) na Naija aktor, daretor an podusa.
How e tek stat life
[chenj-am | chenj-am for orijin]Na for May 14, 1970 dey bon Femi Branch. E papa an mama na tisha for Shagamu in Ogun Stet inside Naijá. E go Satellite Town Primary School for Amuwo Odofin bifor go Airforce Secondary School for Ikeja.Femi leta go Obafemi Awolowo University wey wan go rid Religious Study. E leta get Bachelor of Arts (B.sc) in Dramatic Arts.
Karia
[chenj-am | chenj-am for orijin]Na wen Femi dey Obafemi Awolowo University na im e don dey akt.In 1991, Femi dey insaid e fest fim an na one Yoruba fim wey get di nem Eniyan.E leta akt insaid anoda fim wey get di nem Orisun(minin:Origin) wey memba of staff of Obafemi Awolowo University produs. Femi fest akt in Televishion sho na MTN Group televishion komashia wey get di nem "Dance with me".Femi du di pat of Oscar in di T.V sho Domino. E don akt insaid ova 100 Naijá fims an som of dem na im daret or produs dem.