Fatai Rolling Dollar

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Prince Olayiwola Fatai Olagunju (Dem bon am for July 22, 1927 an e dai June 12, 2013) wey pipul nonwel-wel as Fatai Rolling Dollar na Naijá muzishian. BBC tok sey e bi "nationally celebrated performer". Fatai Rolling Dollar dai wen e bi 85 years old an forma Presido Goodluck Jonathan tok gud tins abaut am.

Tori of e life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Fatai stat to dey sing in 1953. Fatai don tich meni musishian how to sing an Ebenezer Obey an Orlando Owoh bi som of Dem wey e tich.Fatai no how to yuz gitar plai wel wel.Muzik wey mek Fatai popula wel wel na "Won Kere Si Number Wa".

For 1957, e stat one grup wey dem bi 8 pipul insaid an di nem of di grup na Fatai Rolling Dollar and his African Rhythm Band an dem rekod plenti long muzik for Phillips West Africa Records.

How e tey dai[chenj-am | chenj-am for orijin]

Fatai slip an e no wake up.Na for Ikorodu insaid Legos dey beri im bodi. Fatai Rolling Dollar na di musishian wey old pass for Naijá Muzik indostri.