Farida Jalal

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Farida Jalal (Dem bon am November 2, 1985) na Naijá fim aktress for Hausa fim indostri kol Kannywood

Tori of e life an skul wey e go[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for November 2, 1985 dem bon Farida Jalal for Katsina insaid Katsina Stet.Na for Kastina e go skul.Wen e wan stat to akt fim, e go Kano Stet go dey akt for Kannywood wey bi Hausa fim indostri.

E karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for 2002 Farida enta fim indostrie an sins den e don akt meni fims.Som of di fim wey Farida dey insaid bi:

  • Yakana
  • Sansani
  • Madadi

Kano Stet Govament one taim no gree mek e dey akt again bikos of som fim wey e akt wey di Govament no laik. Na for 2019 e kom bak dey akt again an dat taim, Farida tok sey e wan rilis e own fim.For one tok wey BBC Hausa du wit Farida, e tok sey na enihow dek dey du am for Kannywood indostrie. Farida tok sey na moslim Muzik e wan put e pawa ontop now.

Ha persona life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Farida don mari bifor bot di marej skata. For di marej, e get two pikin bot one don dai. Farida no get hosband now.