Family Folklore

From Wikipedia
Family Folklore
Subclass offolkloristics Chenj-am

Family Floklore na di kain kolsho an tradishon tori wey dem dey Kari fom one famili to anoda. Dis one na tori an som kain tins wey don hapun insaid famili wey dem kip an rekod. Famili fotos dey insaid, fotos album, an tins lik certificate, letters, notes, an shopping lists. Wetin famili lik to tok an du wey bi tru dey holways dey insaid rekod to tek dey rememba di famili. Som kain tins wey famili dey lik du, som kain beta tins na im dem don forget.

Famili floklore don tay wey don dey for rekod for difren plez, kolsho, religion or dia wok grup. Dem hie kol in 1958 fom pesin wey dey insaid pipo wey lik to tins abaut kolsho, Mody Bothright, sey mek dem rekod famili wahala, plenti pipu wey lik tins on kolsho ansa am wey kon mek dem pas plenti tori an tradishon fom dia famili. In di 1970's dem don kount important tin for dia famili grup. L Karin Baldwin's buk, wey e no du kom out in 1975 folo wetin mek tori abaut famili grup dey strong. E rait for di buk dey di first fest grup wey pesin dey kom fom na fom famili.

Afta dat one e kon stil xplain wetin famili mean mor mor. To som oda memba of di famili, lik famili wey get pikin an gran papa an mama, wey stil kon get man wey dey mari man insaid, papa an mama wey Neva bon pikin but go get pikin for anoda plez. Famili tradishon dey chenj an na so tins dey chenj too. Di stodi of famili floklore difren fom famili histri. No bi di dates, wia dem kom fom an wia dem tek du som tins, dis aria dey stodi difren beta tori, hau dem dey du tins, an handwok tins wey di famili dey du. Famili tori on kolsho tori abaut famili dey chenj to holways mek pipu ci hau di famili bi. Famili kolsho tori dey tok abaut di famili tori. In 1996, Amerika pesin, Barre Toelken, wey lik to dey stodi an rait abaut kolsho rait sey: For one famili, tori abaut dia kolsho na wetin don hapun to dem for past. As tins wey hapun wey dem no plan dem dey rekod am wit fotos, an hau dem tek e s diasef, dem dey holways saf am in a way wey dem go tek fit rememba dem an njoi am. Di famili way go dey popula as plenti pipu go no abaut am. Dem dey holways chenj Di tori for fotos an oda tins dem uze rekod am time afta time.

Famili as folk grup[chenj-am | chenj-am for orijin]

Pikin dem bon or Karo join bodi for famili wey don dey, wey get smol tin for dia bodi wey di famili dey du wella. Di kain konecshon wey dey insaid gran papa an gran mama, konesho wey dey for sinior an brodas for famil, girls an Bois wey dey famili get konecshon sef. Di pikin go gro kon len hau di famili dey du tins. Na di famili bi di fest plez wey pikin dey len kolsho an tradishon tins pas.

The famili tori dey holways chenj bikos of di niu pikin wey dey enta am, an bikos of som pipu wey don gro wey dey kom di famili, ezampu na Wen man wey don gro go mari wuman kon Di famili. Wen dem kom di famili dem fit Kari anoda tin join di famili wey dem go uze add Di rekod wey don dey down bifor.

As di way dem dey ci famili an gada diantori dey big more more, na so di tori wey soround dem bi famili Floklore.

Hau dem tek dey Pas tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

Hau dem tek dey pas tori dey difren fom one famili to di oda, wetin go mek Tori difren na hau Di famili dey liv lif an hau dia memba dey bhav. No bi one pesin fit dey Pas information of di famili evri taim. As famili dey chenj dia way bikoss of marriage, dem bon pikin, ABI Wen pesin kpai, eni pesin fit pick Di famili tori rait an kip. Dis tins fit bi hau dem tek ci niu way to cook or hau dem tek Len to dey tok tori. Wen dey stat to dey pas am to oda membas for di famili, hol dis na im dem go tek no di famili