Evil eye

From Wikipedia
Black and white person wearing mask
A pesin wey kom from Cairo

Evil eye na one bilif wey pipo get sey wen pesin yuz bad belle tek luk you, bad bad tins fit hapun to pesin. Meni times, na jelousi dey korse dis tins. E don tey wey human bein don bilif dis tin. Pipo don put tins like juju for bodi so dat evil eye no go fit hafet dem. Pipo wey dey do risach don find one juju wey pipo dey put for bodi wey e age don pass ova 5,000 years. If 10 pesin for di wold stand togeda, 4 out of dem bilif dis evil eye. Meni kolsho for di wold bilif dis tins. From Midu East go rish Sentra Afrika, from Balkans go rish South Asia. All of dem tok sey wen pesin yuz evil eye tek luk you, mek you redi to dey see bad bad tins for your life.

Meni kolsho don do evri tin wey de dia pawa to fit mek suo sey evil eye no katch dem. Some tins wey dem do na to dey put juju for bodi. For oda kolsho, like Arab, na mek pesin dey tok MashaAllah wen pesin wan dey yuz evil eye luk you. For pipo wey de Brazil, dem dey plant some kind lif for dia kompand. One pesin wey bi G. Tourney menshon di disis wey fit katch pesin wey sombodi yuz evil eye luk pesin. some of dem na: yellow fiva, eye problem, mek pesin dey yawn.

Di orijin of evil eye bilif[chenj-am | chenj-am for orijin]

E don pass ova 5,000 years wey pipo don dey du juju mek evil eye wahala no hafet dem. One raitin wey de Ugarit wey bi ship port in Syria sopot dis bilif. Dorin di Greek time, big big pesin like Plato, Plutarch, Heliodorus, an Pliny the Elder tok abaut evil eye.