Etim Inyang

From Wikipedia

Etim Okon Inyang (dem bon am for December 25, 1931 an e dai for September 26, 2016) na Naijá polis man an e bin big pesin for Naijá polis dat taim wen e dey alaif. Na for 1983 dey mek am bi di oga kpata-kpata for polis afta Sunday Adewusi. Afta Inyang du e own finish in 1986, na Muhammadu Gambo Jimeta kom kontinu. Inyang dai wen e bi 84 years for Lagos for Naijá.

Tori of e laif an skul wey e go[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Enwang Mbo for Akwa Ibom dey tek bon Inyang. Okon Iyang wey bi e papa bi di king for Enwang Mbo. Inyang go Roman Catholic Skul for Uko-Akpan (1936 - 1937).E stil go Methodist skul for Oron (1939 - 1940) an Oyubia Sekondiri Skul for Oron (1941 - 1945). Na tisha wok Iyang dey du for 1946 go rish 1949 bifor e stat to du polis wok.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Inyang stat polis wok for Naijá as Constable for October 1949.E kom bi Lans Corporal for 1957 an de mek am Corporal for 1958. For 1958, Inyang bi Inspector an e kom bi Assistant Superintendent of Police for 1960 go rish 1963.E kom bi Deputy Superintendent of Police (1963 - 1965) an Superintendent of Police for 1965. For 1967 go rish 1971, Inyang bi Chief Superintendent of Police, E bi Assistant Commissioner of Police (1971 - 1974).Inyang kom bi Commissioner of Police (1975 - 1980). For inside 1961 go rish 1971, E wok for INTERPOL ofis for di side wey dey chuk eye for pipul wey dey du bad tin wel-wel. For 1974, Inyang bi di oga for di pat for polis wey dey kontrol di wey moto an pipul dey yuz road. Inyang kom bi Assistant Inspector General of Police (1980 - 1984) an Inspector General for 1984.

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]