Ethel Rudkin

From Wikipedia

Ethel Rudkin (Dem bon am in 1893 an e kpai on 21 September1985) na Inglish raita, histrie tela, tradishional tori tela an pesin wey dey stodi wey tin dey komot inside ground.Na from Lincolnshire dey tek bon am.Rudkin de among dos wey fest to dey kolet tradishional tori matiriha abaut Lincolnshire an som of wetin e kolet de Meni poblik institushon an North Lincolnshire Museum.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for 1893 dey bon Ethel Hutchinson in Willoughton, Lincolnshire.E papa an mama nem na Richard an Ethel Hutchinson.Rudkin mama famili kom from Suffolk.Wen Rudkin stil dey young, e dey tish an tekia of pikin wey one famili get.In 1917, Rudkin mari George Rudkin wey kom from Folkingham.Akordin to wetin dey rait for e obituari di marej swit bot e no last as e hosband kpai one year afta marej in 1918.George wey bi e hosband bi ofisa in di Machine Gun Corps dorin di Fest Wold War an e kpai bikos of di sikness way happun dat wen kash pipul for nose, throat.Dey giv e hosband one awod wey bi Militiri kross.Wen George kpai, Rudkin go bak to Willoughton to de wit e paret an tekia of dem. Leta in Rudkin life, Lucy Arliss join am stey togeda an e hep am to dig ground to get matiriha for e wok.Lucy Arliss no leave Rudkin ontil e kpai.In 1972, Rudkin an Arliss go stey for one smol house in Toynton All Saints near Spilsby.Afta som years, Arliss kom kpai.Di nik nem wey Rudkin frend dey kol am na "Peter".

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Even sey Rudkin papa an mama no like am, Rudkin like to dey lisin an kolet matiriha wey tok abaut di tradishional tori of Lincolnshire.Meni of wetin e kolet stat in di year 1920s an 1930s.Na Rudkin hep C.W Phillip to chek di old buidin for war survey map.In 1931, e join di Di Folklore Sosaeti an Margaret Murray enkoraji am on e wok wey e dey du on Lincolnshire. Rudkin polish e buk Lincolnshire Folklore wit introdushon by Murray in 1936