Esther Olukoya and Emily Ogunde

From Wikipedia

Esther Taiwo Olukoya an Emily Kehinde Olukoya Ogunde (Dem bon Dem for 1913) bi Naijá twins wey dem bon for Ijebu Ode for Ogun State insaid Naijá.Dey bi kabon kopi of demsef. For March 26, 2013 Esther an Emily du dia 100 years baday dis one mek dia two bi di twin wey old pass for di hole Naijá. By di taim wen dey du dia baday, Esther no fit waka norma again an na chair wey dey dem push e dey yuz.Esther an Emily dey bai an sell tins.Emily mari Hubert Ogunde one Aktor wey popula for Naijá.Pipul wey kom fom dia famili dey liv long bikos dia mama sef dai wen shi bi 104 years old.Esther an Emily tok sey dey liv long bikos dem no dey drink or smoke bot sey na dia belif in God dey hep dem.Na for September 2013 Emily dai an e get one boi.Emily get plenti grand pikin dem for oda famili, Esther kom dai for 2018.

Wia we see pruf[chenj-am | chenj-am for orijin]