Esther Audu
Man abi wuman | wuman |
---|---|
Kontri wey e kom from | Naija |
Fest nem | Esther |
Famili nem | Audu |
Wen dem bon am | 22 March 1982 |
Ples wey dem bon am | Lagos, Ikeja |
Wok wey e dey du | actor, film actor |
Wie e go skul | Univasti of Jos |
Esther Ene Audi (dem bon am for March 22, 1982) na Naijá aktres wey pipul no wel wel for di fim wey e akt laik Inikpi, Dinner, Mystified an Order of the Ring.
How e tek stat life an skul wey e go
[chenj-am | chenj-am for orijin]Na March 22, 1982 dey bon Esther for Ikeja Legos insaid di famili of Mr James Audu.Esther papa na ritaya militiri ofisa wey saf for Ikeja kantoment an na dat barak dey bon Esther an dia five oda pikin.Esther na di last pikin of di famili. Esther papa kom fom Olamaboro wey dey kogi stet.Esther go pamari an junior sekondiri skul insaid Legos.For 2002, Esther famili pak go Abuja an na dia e finish e sekondiri skul. Esther rid Business Management for University of Jos an kolet I'm satifiket (Ba.) in 2010.
How e tek stat dey akt
[chenj-am | chenj-am for orijin]Na fom sekondiri skul Esther don dey akt.Wen Esther dey smol, na pipul wey dey tok Niuz e wan bi like bot E chenj im mind wen e join Drama an literary clubs.Esther dey di pipul dem wey dey chuz to go fom Naijá to patisipet at Kidafest for Ghana in 1996.Sins dem e kom like aktin wel wel pass to dey tok niuz.Di two fims wey Esther rili akt insaid bi Ungodly Romance an Sins of Raphael in Jos an na Alex Mouth produs am. E tok sey na dis two fims mek pipul no am for Nollywood.Wen Esther dey skul, e stil dey akt fim. Esther dey one wey di nem na Fatai Mistake by Nobert Agagu an na sopotin rol e akt for Fatai Mistake.
E pasonal life=
[chenj-am | chenj-am for orijin]Esther marri Mr Philip Ojire wey bi Bizness man an na im bi Fonda of shirt freak.
Fim wey e akt insaid
[chenj-am | chenj-am for orijin]Year | Fim | Rol | Note |
---|---|---|---|
Ungodly Romance | |||
Sins of Rachael | |||
Fatal mistake | |||
2009 | Behind a simile | ||
2010 | Best interest | ||
2010 | Best interest | ||
2012 | Two Hearts | ||
Royal Grace | |||
Judas Games | |||
Bachelors Hearts | |||
2013 | Return of the Ring | ||
2016 | Dinner | ||
2017 | Mystified |
Awod an Nominashion
[chenj-am | chenj-am for orijin]Year | Awod | Katigori | Fim | Resot | Ref |
---|---|---|---|---|---|
2017 | Best of Nollywood Awards | Best Aktres in a liding rol English | Inikpi | Nominated |