Estella Canziani

From Wikipedia

Estella Louisa Michaela Canziani (dem bon am for January 12, 1887 an e kpai for August 23, 1964) na British wuman wey dey draw, dey paint, dey rait an e dey stodi an rekod how dem dey du tins for lokal ways.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for London dey bon Estella Canziani on January 12, 1887. Canziani bi di gel-pikin of Louisa Starr an Enrico Canziani (1848-1931). Canziani papa Enrico Canziani na painta an e mama Louisa Starr na Italian sivil enjiniha. A for di famili house wey dey 3, Palace Green inside Kensington Palace e tek spent all e life. Na aktist Canziani bi an e fest stodi for "Copernicus". Copernicus na one Kensington skul wey Sir Arthur Cope an Erskine Nicol dey kontro. Canziani stil go Royal Akademi skul. Canziani show some of e paintin wok for RA London, Liverpool, Milan, Venice an France. Di paintin wey dey tek no Canziani na "The Piper of Dreams" wey e yuz wota kolor paint. E show di paintin for pipul to si at di Royal Akademi in 1915. Meni pipul don copi an du paintin wey resembu Canziana paintin an e almoat wan bi di same of nomba of pipul wey ri du Holman Hunt paintin The Light of the World. Canziani travul wel wel araund Europe, espeshiali Italy.Di paintin wey e dey du dey show how lokal pipul dey diress an dey du tins in di vilej wey de I side inside Norta Italy. Canziani stil dey draw for buk. Canziani stil dey rait buks. E don rait three buks: Costumes, Tradition and Songs of Savoy (1911), Piedmont (1913) an Through the Appennines and the Land of the Abruzzi. Bikos of di buks wey e rait, Canziani nem de memba of di Royal Jihogtafikal Sosaheti. Canziani rait meni hatikul in di jonal of di Folklore Sosaheti. Canziani rait e own life tori inside di buk: Round About three Green (1939) Dey kip meni of Canziani wok for Birmingham Museum & Art Gallery