Esan Pipul

From Wikipedia

Esan pipul na one big grup of pipul wey dey for di southern pat of Naija, wey get di sem orijin, an dem biliv in di sem kolshor, rilijion, languej an meni meni oda tins dem. An na Esan languej dem dey spik. Pipul sabi Esan pipul sey dem bi farm woka, herb doktohs, big worrior dem wey dem dey hire wit money, an dem bi hontas. Dem dey fam pam tree dem, bush mango dem, cherry (Agbalumo), Pepper, kokonut, betel nut wey ibo pipul dey kol (Utazi), blak pear, kokoyam, avokado pear, yam, kassava, maize, rice, kola, beans, groundnut, banana, orange, plantain, sugar cane, tomato, potato, okra, pineapple, pawpaw, an difrent difrent type of vegetable dem. Pipul biliv sey di present Esan pipul don dey togeda from di 15 senturi wen di sitizin an most of di prince dem wey pipul sabi well well komot from dia neboh dem wey bi di Benin empaya wey dey for di northeast, Dey fom komuniti dem, an kingdom dem wey dey call eguare among di indijin dem wey dey mit for die. Dem dey for all di 35 kingdom wey dey establish for di land of Esan, wey inklud; Amahor, Ewohimi, Ekekhenlen, Ekpoma, Emu, Ekpon, Ewu, Ewato, Ewosa, Idoa, Ifeku, Igueben, Ilushi, Inyelen, Irrua, Ogwa, Ohordua, Okalo, Okhuesan, Onogholo, Opoji, Oria, Orowa, Uromi, Udo, Ugbegun, Ugboha, Ukhun, an Uzea, Ubiaja, Urhohi, Ugun, Ujiogba.

Di Esan kingdom dem fait war agenst diasef, wit di war, di Esan pipul still dey keep di sem kolshor wey di Benin empaya chief dem don influens dem wit. For September 1897, di oyibo pipul (British Empire) kom tek kontro an tek ova dis kingdom dem, wit di Benin empaya, dey kom get fridom afta 63 years for 1960 wey Naija get fridom from di oyibo pipul (British colonial rule). Diwar wey Esan pipul fait bitwin diasef mek dem sorfa som fisika problem for dia laif laik pohvati an lak of infrastrokshor. Di main languej of di Esan pipul na Esan languej wey dey rileted tu Edo languej, Anioma an Urhobo languej, Owan languej, Etsako an Isoko languej. Dem konsida di languej sey e dey important for one rijion for Naija, an dem dey teach di languej for dia pramary skull dem, dem still dey yus di languej tu pass infomeshon for redio an televishon. Dem even rekognaiz an dey kaunt pipul wey dey spik di Esan languej for dia kingdom. Dem kom fit kaunt laik 1 million tu 1.5 million pipul wey bi sitizin dem wey dey difrent difrent ples for di land wey dey spik Esan languej for Naija.

Wetin History tok about dia Orijin[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di wod wey bi Esan don dey wit di Esan pipul for meni hundred yehs an dey don dey yus am befoh dey mit wit di Europe pipul. Meni pipul wey sabi history biliv sey di nem Esan kom from di wod wey bi (E san fia) wey get orijin from Benin wey di meenin na (they have fled or they jumped away).

Ishan na how english pipul kom rait dia Esan, an na bikos dem no fit pronauns di nem of dis pipul well. Biliv still dey wey show sey di kaind koropshon don afekt som nem dem for Esan laik Ubhẹkhẹ naw dem kom call am (Obeche tree), Uloko naw dem call am (Iroko tree), Abhulimẹn naw dem dey call am (Aburime), an meni nem dem laik dat. Dem don try mek dem shenj an reton tu haw e bi from di stat for di tins dem wey konsan buk mata.

Time wey pipul don dey Exist before Dem start to Rait History[chenj-am | chenj-am for orijin]

Akordin to pipul wey stodi materia tins dem laik tuls, pot, stone, wall an oda tins wey pipul dey yus, abaot pipul wey don leev for di taim wey pass (archaeologist) an evidens from languej, pipul don fest stey for di savannah-forest an area dem wey dey bitwin som place dem for di land wey dey Esan for laik 3000 yehs before. From 500 AD to 750 AD, som hunta wey bi dia laif stail na only to dey hunt, dey kill fish an dey do oda tins laik to dey gada honey for living na im dey rely on to dey sorvaiv, dis pipul start tu stey for di savannah-forest wey bi place wey dey warm an som taim ren dey fall for dis plasis dem for di land of Esan an dem stey for wie forest dey for di Benin empaya. Dem don dey before di Esan an di Edo sosaeti wey kom build tins dem wey advans laik place dem wey get difens dem an wall dem around di family propati dem. Dis plasis wey dey build tins round dem na plasis wey tins wey dem build tu demaket wie pipul dey stey an farm propati rish 3 to 5 kilometers. Dis propati dem kom big an bikom vilej demand for 800 AD, dis vilej dem kom gada tu fom kingdom wit important pawa. Di finding wey dem do for dis awa taim kom show sey Wie Dem buid di wall sem dat taim na eastern part for Benin empaya an na for di northern part for Esan land. Pipul kom stat tu stey for pamanent plesis wey dey near wie water dey flow for di high land dem wey dey for di northern part.

Na how plenti pipul tek dey moov from plesis tu Esan teritry for di sem taim na e influence di kolshor, languej an growth wey dey for di land of Esan well well. Komuniti dem for Esan land wey dey di south an east part wey bi sey dem bi (Ewohimi, Ewatto, Ekpon, Amahor) na Igbo an Igala pipul plenti for die na dem bi di (Uroh); Emai pipul kom from di north kom enta (Ukhun, Idoa) an di Amahor an Etsako kom enta (Irrua), from di south, di Itsekiri enta (Ekpon) an Urhobo enta (Ujiogba).

Na Edo pipul influens Esan land well well wey bi di founda of Benin empaya. For 1460, Oba Ewuare kom pass one law wey hard for pipul tu folo wey dey don stop laik (sexual intercourse, bathing, drumming, dancing, and cooking). Dis law Dem dey hard an e no dey eezi for di sitizin tu follow, na e mek di pipul run go di kingdom of Esanland. Na dis movment kom shape di Esanland modern kolshoral identity wey mek bring di wod Esan, or refugee. Di nolej wey pipul don share about art an kolshor don sopot dis obsavashon for di tins dem. Pipul wey sabi history mata for Esan an Edo don gada plenti stori about dis movment.

Before Dey kolonaiz Dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

Esan kingdom get difrent digri for di wey dem tek gorven diaself, but na Benin empaya get di high pawa wey high wey di Esan pawa dey onda am. Na di Oba of Benin apruv di enijie of Esanland an Esan kingdom dem dey giv honor to di Oba of Benin. Dem still get meni rekod for fight bitwin di Esan kingdom an di Benin kingdom. Dis one na bikos of Oba, wey dey for di throne wey send white chalk to di Esan pipul wey e mean di sign of friendship bitwin di two kingdom dem. An if Esan pipul reject di chalk, den di Oba go won try enta di Esanland an fight dem. Di difrent wey dey for dia politika stability wey dey bitwin di Benin kingdom an di Esan kingdom still dey cos fight fight bitwin dem. Dat kain fight fight dey komon bitwin dem sotey no rekod for eni history dem wey show sey peace dey bitwin di Esan kingdom an di Benin pipul.

Esanland dey do wold tred well well dat time. Benin wey high ova di Esanland for Position mata na e mek dem to dey send for treda wey kom from far place dem, or ekhen. Ekhen dey sorply cloth, ivory, peppers, an slave dem for di Europe pipul wey dey do buy and sell wey dey for Yorubaland, Esanland, an Afenmai. Di Uzea war hapun for 16th senturi, dis na di fight fight wey hapun bitwin di Uromi kingdom an di Benin kingdom. Di last from 1502 go rish 1503, an na e leed to di rizin why di Oba Ozolua for Benin refius to bikom friend wit Onojie Agba for Uromi.

Di war kom end for di wey dem dey call Uzea, na dat time dem kill di two leader dem. So, for di time wey peace kom dey, di Esan kingdom kom dey send soja dem to Benin kingdom wey dem go leta pay for dem. Like for di war wey hapun bitwin 1515 to 1516 for di time of Idah, an di sacking of Akure for 1823.

For 19th senturi, dem kontinu tu dey atak di north part of di Esanland wen di Nupe Muslim dem dey luk pipul wey dey go dey yus for slave, sotey di Nupe Muslim pipul tek ova an turn dem to Muslim, afta dey don tek ova di Kukuruku pipul land. Meni Esan kingdom dem wey kom from di south kom help for di fight for dem tu atak di Nupe pipul wey dey atak dem. Esan pipul kom get favoh for di atak wey dey atak dia pipul dem, dey kom kari plenti Nupe an Etsako worior tu Esan siti wey bi sey na die dem dey dey prospa till dis awa taim. For dat 19th senturi, di Oyibo pipul dey demand for palm drodukt from di land, na dat taim Europe pipul kom influens Esanland well well.

War For Esan an Kolonaizashon[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 1897, di British pipul kom find out about Benin for 1897, wey mek di Esan get fridom from di Benin kingdom. For 1899, British pipul kom enta an distob di Esan kingdom for seven yehs. Pipul for Esan kom show sey dem strong tu konka pass di Benin pipul bikos dia govment strong an get pawa. Di kingdom dem kontiniu tu fight di British even wen dia neboh dem don sorenda for fight. Som chief dem wey dey don win for war like Ologbosere an Ebohon still dey stand agenst di rule dem wey di British pipul don yus style style put for di Esan pipul land wey dey guide dem for di west part wey dem put militry post an dey block raod dem. E last from 1897 go rish 1899, na die Ologbosere kom sorenda for bohda wey dey for Okemue vilej.

Di kingdom wey di British pipul fest atak na Ekpon kingdom. Ekpon kom kari fear put for di British pipul mind an kom dey agenst di wey di British pipul enta dia land tu fight dem for April 22, wey lead tu di mont wey dem get katakata. Afta di British pipul fest enta tu fight di kingdom, Ekpon kom dey for one place an kom dey konfius, an letah for April 29, di Ekpon kingdom kom go mit di British pipul wit soprais atak for Okemue wie dem gada put dia kamp. Na dis one mek di British soja dem kom go bak tu go gada pawa for dem tu dey strong dey kom bak to fight an win an dey kill Ologbosere for May. Di British pipul kom fail as dem dey try tu kom an fight dem more more, as dem tek kontro for Irrua na e mek dem bring di imajensi katakata plan wey mek di British dem kom sorenda. Oda Esan Kingdom dem kom dey yus dis imajensi plan wey kom help dem wey mek di British no go fit enta Esanland tu fight dem till 1901.

For 16 March 1901, Di British pipul atak di Uromi kingdom wey dia head for die na wise man Onojie Okolo. Prince Okojie Uromi kom respond dem wit veri fast imajensi war plan. Afta small taim, di British sojas kom kill Okolo for wie e dey for di Amedokhian vilej afta dey don tek ova di vilej. Na dis one kom vex Prince Okojie sotey e kill di British sojas dem kapten before dey kom go gada more tins tu fight. Di British kom notis sey Uromi pipul no eezi tu fight wit If dem no get netiv help, na die dey go mit lokal soportah dem laik Onokpogua wey bi di Ezomo for Uromi. Na dis one kom mek dem kidnap Prince Okojie from di forest an send am go mit di British for dia offis for Calabar. So na dis style meni kingdom dem wey fight wit di British dem kom kohpi, di Esan pipul kom laik to dey yus di imajensi plan well well wey letah bring long taim katakata as dem no even get beta weapon dem go bak go gada pawa for diasef well from Benin City to fit fight di British dem. Di taim wey dem kapshor di vilej den di intana resistans na vaolent,di imajensi war plan wey kontiniu for Uromi soja dem na e mek di British dem tu fit rilis Prince Okojie. Di British dem kom vex an stat to distroi meni vilej wey dey don kapshor dem. But, for 1906, Esanland kom asept di British rule dem, an di 34 kingdom dem wey bi Esan pipul own kom dey onda di British pipul for Naija

Esan Pipul Musik an Dans[chenj-am | chenj-am for orijin]

Esan pipul dans na one kaind dans wey bi sey e no dey eezi tu dans an e dey very interested tu watch, na di kaind dans wey involv tu dey muv bodi for di wey enihaw pesin no fit trai am (acrobatic dance) an na yung men dem dey parfom for di dans, meni of Igbabonelimhin na e dey for di dans, Igbabonelimhin na tu dey twist yoh bodi an dey do somasolt as di beat dey kom out from di drum. How di vilej dem for Esan dey operate dey difrent for eesh oda. Dem dey fix did small fight for days dem wey dem fix for di pafomans. Onda nomah tin, na evri two week dem akodin tu Esan kalenda or for market day for di difrent vilej an town dem wey gada tu bikom Esan na e dem dey do di Igbabonelimhin pafomans. Igbabonelimhinsopos bi dans wey dey sopos dey dans to mark selibreshon dem laik end of year, niu yam festiva dem, an soshia funkshon dem, laik berial serimoni. For Esan, di dans na one dans wey dey show speshia simbol for Esan pipul of awa taim wey dey evriwie.

Esan Pipul Tradishon And Dia Rilijion[chenj-am | chenj-am for orijin]

Esan Pipul tradishon an lokal stori dem laik igbabonẹlimhin and akhuẹ, na one wey of lernin an na entatenment e still bi. Di Esan Pipul get important tradishonal ruler for dia sosieti wey dey mek tins tu dey orda for dia sosieti wie biuti an beta bihavior dey dey togeda. As e bi sey Kristen don dey for die for veri long taim, plenti Esan Pipul still biliv in tradishon an dem dey wohship dia papa dem spirit an oda small small god dem. Plenti pipul for Esan still bi Kristen dem, meni of dem na Catholic an e neva teh wey som of dem stat tu go oda shorsh dem. Na difrent difrent lokal languej dem dey for Esan vilej wey bi sey na from Bini languej, di Esan an Bini pipul still get somtins dem bitwin dem wey mek dem dey somhaw close, na e mek dat seyin wey tok sey Esan ii gbi Ẹdo wey di meenin na Esan no dey do bad tin for Ẹdo wey e still meen Bini. E get oda transleshon dem wey tok sey Esan gbe Edo wey e meenin na Esan don win Bini. Di Esan pipul dem tradishon for rilijion mata resembu Edo pipul tradishon for rilijion mata well well, bikos of sey di Esan pipul komot from Bini empaya tu di southeast for di 15th senturi, E get meni small small god dem wey bi di Esan rilijion wey Bini pipul sef dey serv.

Osabobua, na di main Edo an Esan pipul god. Kristen dem an di pipul wey dey travul tu prish dem kom kari di nem sey di nem na for God. For Esanland dem translet God nem say na Osanobua e bi.

Olokun

Esu, na di Esan pipul god wey get koni koni way. Di Yoruba pipul an Edo pipul get di sem tradishonal biliv for dis god. Di wod wey bi Esu, Kristen wey bi mishonari dem kom translet am sey na Satan bi di meenin.

Osun, na di god of medisin for di Esan pipul, na hie di pipul wey dia surname na Okosun kom from, an di meenin na son of medisin.

Femous Naija Esan pipul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Anthony Enahoro : journalist, politician, former Federal Commissioner, former Chairman NADECO, raised the motion for the independence of Nigeria in 1953 at the age of 30.

Augustus Aikhomu : Navy Admiral and former military Vice President of Nigeria.

Ambrose Folorunsho Alli : Professor of medicine, Governor of Bendel State and the founder of Bendel State University, later posthumously renamed Ambrose Alli University.

Anthony Anenih : Police officer, politician, former Chairman Party, former Social Democratic PDP Board of Trustees Chairman, and former Minister of Works and Housing.

Tom Ikimi : Architect, politician, former chairman, National Republican Convention and former Minister of Foreign Affairs.

Festus Iyayi : Writer.

Stella Obasanjo : The First Lady of Nigeria from 1999 until her death.

Anthony Olubunmi Okogie : Cardinal and former Archbishop of Lagos.

Sonny Okosun : Musician.

Chris Oyakhilome : Evangelist and president of Christ Embassy.

Fidelis Oyakhilome : former Lagos State Police Commissioner and former Governor of Rivers State.

Amb. (Dr.) Martin Ihoeghian Uhomoibhi : former President of the United Nations Human Rights Council.

Victor Ehikhamenor : Artist, writer, and photographer.

Peter Enahoro : Journalist, writer, columnist, and author of the book, How to Be a Nigerian.

Julius Okojie : Former executive secretary, National Universities Commission.

Esan Pipul Tradishon And Dia Rilijion[chenj-am | chenj-am for orijin]

Esan Pipul tradishon an lokal stori dem laik igbabonẹlimhin and akhuẹ, na one wey of lernin an na entatenment e still bi. Di Esan Pipul get important tradishonal ruler for dia sosieti wey dey mek tins tu dey orda for dia sosieti wie biuti an beta bihavior dey dey togeda. As e bi sey Kristen don dey for die for veri long taim, plenti Esan Pipul still biliv in tradishon an dem dey wohship dia papa dem spirit an oda small small god dem. Plenti pipul for Esan still bi Kristen dem, meni of dem na Catholic an e neva teh wey som of dem stat tu go oda shorsh dem. Na difrent difrent lokal languej dem dey for Esan vilej wey bi sey na from Bini languej, di Esan an Bini pipul still get somtins dem bitwin dem wey mek dem dey somhaw close, na e mek dat seyin wey tok sey Esan ii gbi Ẹdo wey di meenin na Esan no dey do bad tin for Ẹdo wey e still meen Bini. E get oda transleshon dem wey tok sey Esan gbe Edo wey e meenin na Esan don win Bini. Di Esan pipul dem tradishon for rilijion mata resembu Edo pipul tradishon for rilijion mata well well, bikos of sey di Esan pipul komot from Bini empaya tu di southeast for di 15th senturi, E get meni small small god dem wey bi di Esan rilijion wey Bini pipul sef dey serv.

Osabobua, na di main Edo an Esan pipul god. Kristen dem an di pipul wey dey travul tu prish dem kom kari di nem sey di nem na for God. For Esanland dem translet God nem say na Osanobua e bi.

Olokun

Esu, na di Esan pipul god wey get koni koni way. Di Yoruba pipul an Edo pipul get di sem tradishonal biliv for dis god. Di wod wey bi Esu, Kristen wey bi mishonari dem kom translet am sey na Satan bi di meenin.

Osun, na di god of medisin for di Esan pipul, na hie di pipul wey dia surname na Okosun kom from, an di meenin na son of medisin.

Lokal Govment Area dem For Esan For Edo Stet[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na dis bi di how dem arenj di ples dem wey Esan pipul get fridom for dia kingdom to rule ova for dis awa taim an how dey arenj am onda faif lokal govment area dem:

1. Esan-North-East LGA, Uromi: Uromi and Uzea.

2. Esan Central LGA, Ugbegun, Opoji, Irrua: Irrua, Ewu, Ebudin.

3. Esan West LGA, Iruekpen, Idoa, Ekpoma: Ekpoma, Ogwa, Urohi, Ukhun, Egoro and Ujiogba.

4. Esan South East LGA, Ubiaja:, Ubiaja, Ewohimi, Emu, Ohordua, Ẹwatto, Okhuesan, Orowa, Ugboha, Oria, Illushi, Onogholo, Inyenlen.

5. Igueben LGA, Igueben: Igueben, Ebelle, Amaho, Ẹwossa, Udo, Ekpon, Ugun, Okalo.

Wie Dem Gada di Tori[chenj-am | chenj-am for orijin]