Erastus Akingbola

From Wikipedia

Erastus Bankole Akingbola MON, FCIB, FNIM (Dem bon am for October 26, 1950) na Naijá banka, bizines man an pesin wey dey hep di pipul wey no get moni.Erasmus bi di big boss( maniji dareto) Intercontinental Bank an oda kompini like Tropics Finance and Investment Company an Inspiration 92.3 FM.Erasmus bifor bifor na shihaman of Associated Discount House limited.Wen West Afrika kontris wan chuz pesin wey go tok for dem in The Executive Board of the African Bankers Forum in 2004 (AFREXIMBANK), na Erasmus dey chuz.Dat AFREXIMBANK na to mek suo sey bank wey no bi Govament bank go dey wok wel an go dey strong to dey du bizness for Afrika.  

How e tek stat Life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Erastus Akingbola for October 26, 1950 in Ilesa, Osun Stet for insaid Westa Naijá.Erasmus papa na Shif Samuel Orogbode Akingbola wey bí Choch katekist an Tisha an im mama na Mrs Christiana Akingbola wey bi buksella.Erasmus kom fom Oke-Igbo insaid Ondo Stet for Westa Naijá. Erastus bin go Christ's School, Ado Ekiti bitwin 1965 an 1969. Fom dia, e rid buk kom kolet diploma satifiket kol Associate Diploma of the Institute of Bankers, AIB, London for 1975.Erasmus go University of Lagos go du post graduate kouse for Business Administration wey e finish for 1986, kom get Master of Business Administrations, MBA, insaid General Management. Afta dis, e kom stil get satifiket for OPM for Harvard Business School for year 2000.

E karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

Erastus Akingbola stat im karia insaid banking wit Union Bank of Nigeria Ltd for 1971, wey im join as klark.E leta join NAL Merchant Bank in 1977.By December 1984, Erastus Akingbola don bikom senior manija, International operations and correspondent banking. Na dis posishion wey e dey till February 1987 wey e waka go join anoda investment bank wey bi First City Merchant Bank Limited, as kontrolla of operashions. Na fom dia e tek join oda pipul fom Nigerian Intercontinental Merchant Bank Limited wey leta chenj to Commercial Bank wey dem kol Intercontinental Bank Plc an dem kom mek am di Maniji Dareto (M.D). By di taim wey CBN komot am fom ofis for 2009, Erasmus don kari di bank enta Ghana an United kingdom an di bank don get ova 12,000 woka wey dey wok di bank.

=Awods an wetin e ashif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Erastus Akingbola na Fellow of Chartered Institute of Bankers of Nigeria(CIBN) wia e bi one taim Presido of di Association of Bankers dem for Naijá. Erasmus folo saf as Presido of Institute of Chartered Secretaries and Administrators of Nigeria (ICSAN) inkludin dat of Lagos Business School Alumni Association (1998).Erasmus bi Fellow of the Nigerian Institute of Management, plus di Chartered Institute of Bankers, London. Na im bin repisent West Afrika for 2004 for di Executive Board of the African Bankers Forum, wey bi one arm of di AFREXIMBANK, wey dey wok to mek suo sey banks wey no bi govament own dey strong wel wel to du koret bizness for insaid di kontinent. For 2001, forma Presido Olusegun Obasanjo bin kari Member of the Order of the Niger (MON), wey bi nashional awod giv am tek praise am for di koret koret kontribushion wey im dey kontribute on how to divelop Naijá.Erasmus also kolet di Kwame Nkrumah Award fom di Nkrumah Foundation insaid Ghana for 2004 as oga kpatakpat of one of di lidin financial institushions in Afrika. For insaid 2004 again, dem bin kari Zik Leadership Award giv am.

How e tek dash pipul tins an Moni[chenj-am | chenj-am for orijin]

Erastus Akingbola don du koret kontribushion to pipul an e don also yuz e Organisashion wey e head tek hep pipul tu to hep mek buildin insaid Hiya institushions for Naijá. Na one of dis kontribushion bi di 120-Bed, 60 Room Post Graduate Hostel wey e build an put beds for University of Lagos in 2006.Intercontinental Bank, wen e bin dey in charge, also build and donate Hostel komplex plus oda buildin to meni Univasiti all ova Naijá, inkludin di University of Lagos, University of Benin, Bayero University, Kano etc.

E don also hep to mek pipul no about gospel wel wel as e don rilis moni to tek mek buk wey dey prich gospel. Sins 2008, Erasmus don yuz e moni dey poblish di magazine The Word for Today a daily divoshion buk wey pupil fit kolet without moni for evriwie for Naijá an som oda kontris.Na Grace So Amazing Foundation dey share di buk an na Erasmus an e waif fom di Foundation. Erasmus bi memba for The Bible Society of Nigeria an e dey hep mek baibu fit dey meni meni langwej.

Personal life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Erastus Akingbola mari Anthonia Tolulope Odesanya an dem bon 4 pikin.