Emily Lyle

From Wikipedia

Emily Lyle (dem bon am for 19 December 1932 for Glasgow) na one Scottishballad student an sinior risash pesin for di skul of Celtic an Scottish stodi dem for di Yunifasiti of Edinburgh.

Hau E Liv E Laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Emaily Lyle grow up for Kilbarchan,Kenfrewshire,Scotland.Shi stodi Inglish langwej an litresho for di Yunifasiti of St.Andrew(MA 1954),an shi kom stil stodi Edukeshon for Yunifasiti of Glasgow(Diploma in Edekeshon,1955). Shi tish Inglish for six yias for Sekondri skul dem for Britain an New Zealand bifor dem kom apoont am as leshora of Inglish for Ripon Kolej of Edukeshon for Yarkshire(1961-65) an shi stil bi Sinior leshora for Inglish for Neville's Cross Kolej for Durham (1965-68). Shi rait abaut Thomas di Rhymer an Tam Lin for Litresho an tradishona.Shi tek am stodi as dokto for itskul of folk-Lifestodi for di Yunifasiti of Leeds. Afta som time shi stop to dey tish Inglish-litresho an kom stat im own wok ontop Sottish stodi.

Hau E do Skul Wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 1976-77,shi go Australia Nashona Yunifasiti for Australia go wok as fellow.As shi dey for Australia, shi stat to dey kolet tins wey konsan Scottish pipul,plus CD "Cho kit on a Tattie" (di spesha tins wey konsan smol-smol pikin song dem an wod dem wey end wit disem saund),an wok ontopbTochter. For 1977,Lyle dash Nashona Laibri of Australia plenti tins wey shi don rekod. Di wok wey shi do for Radcliffe Institute of Harvard Yunifasiti for 1974-75 giv am chans to tek travulbgo Harvard Meni time an mek plenti pipul know am wel-wel. Dem even giv am wok for di senta for di stodi of Wold Rilijon for 1995. Dem apoint am as risash fellow for so skul of Scottish stodi for di Yunifasiti of Edinburgh for 1970 to 1995 an kom stil mek am leshora from 1995 to 1998.As Profeso for folklore shi do som wok for Yunifasiti of California for Los Angeles for 1978.From 1979-1982 shi stil do som wok for folklore stodi for Yunifasiti of Stirling from 1979 to 1982. Na sins 1998 dem don giv am honor as fellow for di skul of Celtic an Scottish for Edinburgh.

Sosaiti wey dey Stodi Tradishonal Sayens of hau tins dey wok for inside Spes[chenj-am | chenj-am for orijin]

E Honor Dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di folklore Sosaiti Coote Lake Risash Medal(1987). Di Royal Sosaiti of Edinburgh Duncan Prize Lesho.