Emeka Offor

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Emeka Offor ( Dem bon am on February 10, 1959) na Naijá pesin wey dey buy an sell petirol oil.

Tori of e life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem born am for Kanfanchan, Kaduna stet.E kom fom Irefi Oraifite for Ekwusigo Lokal Govament aria for Anambra stet, Naijá.Offor du e primari skul for Eziukwu Primary School for Aba, Abia stet an St. Michael Primary School for Ogbete, Enugu. E go Merchant of Life School for e sekondiri edukashion, an e leta go to Aboy High School Ihiala, Anambra Stet.

Wetin e don du[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na Offor fom di Sir Emeka Offor Foundation ( SOEF) so dat pipul wey nid hep go fit get hep an fit takia of demsef. Emeka Offor bi di head of Saint Christopher for Church of Nigeria, an one of di oga for Oraifite, Anambra Stet.