Elna Hansson

From Wikipedia

Elna Hansson (Dem bon am 1814 an e kpai in 1891) na Sweden wuman wey dey yuz tradishonal majik an e dey asists pipul wey sik sef. Na Elna Hansson bi di fest wuman wey join doktor wey den assist sik pipul.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Elna Hansson na di pikin of tradishonal majik wuman Marna Nilsdotter wey de Lund. Marna Nilsdotter bi di fifth jenerashon of majik wuman-dem from di popular famili wey dey pratis tradishonal medisine. E papa an mama get one nem wey pipul dey kol dem an di nem na "Labored". Elna Hansson bikom di mama of di tradishonal wuman Johanna Maria Andersson, an di grama of Hedda Andersson. Elna Hands on live in Malmo afta e marej in 1833, an pipul sabi am wel wel as tradishonal medisine wuman. Jos like e mama, e wok na to trit wound an bone wey don break.Elna Hands on dey difren from oda tradishonal majik hela of dat time bikos e no dey yuz juju tek du e own tritmet. Did one mek pipul respet am an mek pipul as sayens doktor. Elna Hansson rili get beta nem as e du mek meni leg wey oda for don rimuv komot dey Ok. E mek meni pipul fit waka again afta wey dey get assidet. Penti pipul dey kom mit am for evriwie like South Sweden, Norway an Denmark.Bikos of e wok an karatas, meni odas wey de du e wok kari sik pipul kom give am mek e trit dem. Even sey e sabi wok wel wel, e stil neva get satifiket to du dat kind of wok. In 1855, one pesin wey bi August Falck go ripot am sey e na fake as Elna Hansson to get satifiket. Meni pipul rait leta to di king to tok beta beta tins abaut Elna Hansson.Di wahala wey de dat time bi sey, wuman to de go rid medsin for skul dat time. Di king kom rait in 1857 sey from now on mek wuman sey dey go skul go rid medsin bot na to dey sopot di man wey bi doktor. Elna Hansson go di medsin skul an pass di exam.Na Elna Hansson fit bi di fest wuman to du dat for Sweden. E satifiket mek am fit opun e ofisha klinik, an di klinik get room wey seven sik pesin fit stey. Elna Hansson kontiniu to dey trit sik pipul onti e kpai. E pikin wey bi wuman join am in 1866 for di wok afta e sef don kolet satifiket to du di wok. Dat time, e pikin hosband don kpai. Na for 1870 di Sweden Govamet kom grie sey all wuman wey like to rid medsin fit go rid am for skul. Elna Hansson an e pikin kom grie sey mek Elna Hansson gran-pikin Hedda Andersson wey bi di 7-jenerashon of di famili go rid meds in for Yunivasiti. Dey tok dis one bikos dey no wan mek pipul dey tok sey dia famili de pratis fake doktor wey kom from dia jenerashon. Hedda Andersson kom bikom di sekod train wuman to bi doktor in Sweden.