Ellen Stekert

From Wikipedia

Ellen Stekert ( dey bon am in 1935) na Amerika leshoral, pesin wey de stodi an rekod how dem dey du tins for lokal way an muzishan. Stekert na Professo Emerita of Inglish at di Yunivasiti of Minnesota.

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for New York Siti dey bon Ellen Stekert in 1935. E gro up in Great Neck for [[Long Island| Long Hiland]. Na smol rimen e for kpai bikos of polio wen e dey smol. Sketert stat to dey sing traditional old muzik wen e dey sekondri skul an now e don rilis meni rekordin albom.

Sketert go Cornell Yunivasiti an e len for di klass wey Harold Thompson. Harold Thompson na pesin wey de stodi an rekod how dem dey du tins for lokal way. Sketert even hep Harold Thompson tish studet somtimes. Wen di luv wey Stekert get for tradishonal muzik stat to gro, e stat to Waka abaut araund dey rekod an kolet tradishonal song-dem wey singa dey sing for Norta pat of New York. Stekert kolet some muzik from Ezra "Fuzzy" Barhight. Ezra Barhight na pesin wey dey kot tree down for bush an na Cohocton, New York e dey stay. Stekert rekod an rili dos song in 1958 wit di tahitu Songs of a New York Lumberjack Afta wey Stekert rid filosofi in Cornell Yunivasiti, e go du e Masta digri in folklore for Indiana Yunivasiti. For Indiana Yunivasiti, e kontiniu to dey waka abaut koletin tradishonal song in Kentucky an Souta Indiana. Wen Stekert finish e Masta digri finish, e stat e Ph.D in folklore for Indiana Yunivasiti but na Yunivasiti of Pennsylvania e tek finish e Ph.D an kolet e satifiket. Bikos of di way e dey du e supavisor wok, Stekert finish e Ph.D in 1965. Di nem of e supavisor na Richard Dorson.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di fest tishin wok wey Stekert du na for Wayne State Yunivasiti wey de Detroit. For di yunivasiti, Stekert kontiniu di wok wey Thelma G. James fest stat. Di wok bi see e kontiniu to dey kolet an kip di tradishonal ways pipul dey du tins for siti.