Elene Virsaladze

From Wikipedia

Elene Virsaladze (dem bon am January 3, 1911 an e kpai for 1977) na Georgia wuman wey de rait tradishonal tori. Pipul sabi am wel wel for di plenti tins e don rait an how e dey tek ask pipul kweshon on wetin dey sabi abaut tradishonal tori. Meni of Virsaladze raitin don de plenti langwej like Russian, French, German, an English.

How e tek stat life an go skul[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na on January 3, 1911 dey bon Elene Virsaladze. E papa na Ekonomist an e mama na Sayens pesin wey dey stodi plant.Na Virsaladze smol pass for di three pikin wey e papa an mama bon. Wen Virsaladze bi 10 years, di Red soljas fight enta Georgia. Virsaladze papa wan komot from Georgia go Europe but e wife no gri . Virsaladze finish e sekondri skul in Georgia. E leta go Tbilisi Stet Yunivasiti.For di Yunivasiti, na di tradishonal tori raita Vakhtang Kotetishvili de among pipul wey tish am.E finish ridin tradishonal tori an filosofi for yunivasiti in 1930.Virsaladge mari e hosband Shalva Khidasheli in 1931. E hosband leta bikom professor of Filosofi. In 1935, Virsaladge finish from Litireshon, Langwej an Filosofi falkoti wey de Leningrad Stet Yunivasiti for Saint Petersburg, Russia.Di Pepa wey e yuz kolet e Ph.D na "The Genesis of Georgian Folktales" an na 1936 e finish am. For dat sem year, Virsaladze stat to tish woldli tradishonal tori for Tbilisi Stet Yunivasiti.Di pat of woldli tradishonal tori wey e dey tish pass for di Yunivasiti na Russian Tradishonal tori. Na onli one femali pikin Virsaladze get an e nem na Manana. Dey Kil Virsaladze papa an pesin wey e dey luk up to in 1937.Virsaladze nid to run komot to di Far East mek dey no Kil am too onti 1943. Afta 1943, dey kom tok sey e fit kom bak to Georgia. Wen Virsaladze kom bak, na Goti e stey onti 1948 bifor dey kom allow am to kom Tbilisi. E kom stat to wok for Shota Rustaveli Institute pf Georgian Litirashon an na dia Virsaladze tek du e Ph.D. Na for TSU Virsaladze tek bikom professo wen e finish e Ph.D in 1974.E join International Narrative Folklore Society an join for Intanashonal mitins.For 1976, dey mek Virsaladze di hed of Folklore Dipatmet at TSU. Virsaladze kpai in 1977.

E akademik wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Wen e stil dey wok, Virsaladze poblish ova 100 wok. E waka wel wel for Georgia as e dey gada informashon an tins for e wok in 1950s, 60s an 70s. Di Shota Rustaveli Institute stil get di vois rekod an raitin rekod of wetin e gada wen e dey travul abaut.

Som buk wey e don rait[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • The fate of the Georgian mountain peoples, 1958
  • "The Amirani saga and the Georgian hunting epos", in Acta Ethnographica Academiae Scientiarum Hungaricae, 1961
  • "The Main Types of Georgian Folk Pilot Literary", in Literary Researches, 1974
  • Georgian hunting myths and poetry, 1976