Eid al-Fitr

From Wikipedia

Eid al-Fitr wey bi Holu-dey wey pipo dey yuz finish dia fastin na di fest of di two holu-dey wey muslim dey do. (Di sekond one na Eid al-Adha).Na all di muslim dey selibrate Eid al-Fitr bikos na im dem dey enjoin wen di one month Ramadan fastin don finish. Evri muslim wey dey all part of di wold dey do dis holu-dey. For muslim kalenda, di holu-dey dey hapun on di fest day of Shawwai if we yuz islamik kalenda check-am. Di date no dey folo di norma moslim kalenda bikos na wen pipo see di niu moon for up dem go start to do dia fastin.

Difren difren nem na im pipo tek no Eid al-Fitr selibreshon. Some pipo dey kol di selibrashon "Lesser Eid" or jos Eid. Dorin Eid al-Fitr, dem dey do one patikula Islamik preya (sakat) wey dem divide into two part (rakats). Na for big hall or outside pipo dey do dis preya. Dey fit still do dis preya for inside mosque (Jamā at). Wen di preya dey go on, pipo go kari dia two hand up to fit rish dia ear an tok sey "Allāhu 'Akbar" wey mins "God is the greatest.

Afta di preya , muslim pipo go start di selebrashon an dey go dey give an risiv fud from one pesin to anoda.

How e tek start[chenj-am | chenj-am for orijin]

Akordin to wetin dey muslim tradishon, na Islamik prophet Muhammed start Eid-al-Fitr. Some tori tok sey na Medina Eid al-Fitr tek fest hapun afta Muhammed park from Mecca go Medina. One pesin wey dey klose to di prophet wey e nem na Anas tok sey wen Muhammed rish Medina, e see sey di pipo for dia get two days wey dem dey yuz enjoin diasef. Muhammed kom tel di pipo sey God don chuz onli two days to fit do joli joli: Eid al-Fitra an Eid al-Adha.

How di festival dey bi[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na wen sun don go down for di night wey dey see di full moon na im di festiva dey start. Na night wey dey fest see di moon na im dem dey kol Chand Raat. If dem no kwik see di moon on 29 day of di month wey dem soposs see-am, muslim pipo go do Eid al-Fitr di ness day. Di risin wey fit mek am hard to see di moon fit bi sey sky no too klear. Difren kontri fit yuz difren days selibrate di festiva. E dey last from one to three days. Pesin no go eva fast for dat day wey di festival dey go on. E get one patikula preya wey dem dey do at dat day. Bifor dey do di preya, pipo go go give poor pipo moni an tins to show piti on dem.