Edit Hodgetts

From Wikipedia

Edit Hodgetts(shi kpai for 1902)na one pesin from Britain wey dem bon for Russia wey dey rait Smol-pikin stori dem,folk tale,an fairy tales.

Tori abaut E Laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon am for Russia an na dia shi Liv wen shi stil bi Smol-pikin. Micheal Nicolaevitch an Sophie Nicolaevna dem tek as dia girl-pikin. Afta som time, shi kom muv go England go stay dia.Meni pipul know am bikos of e buk dem wey shi gada-togeda tek mek Koleshon ontop Russia fair tales wey shi poblish for 1890 for London. Dem stil print dis Koleshon buk Meni times for 1891,1892,1972,1974,1983,2013, 2015 an 2017. Wen shi dey tok abaut di buk, Hodgetts tok sey di stori dem na wetin shi don dey gada-togeda sins di time wen shi bi Smol-pikin an shi gada dem from skul an from di pipul wey tek kai of an wen shi dey smol.Shi even tok sey dem tranlet som from Russia langwej. Shi dediket di buk giv eselensi Micheal Nicolaevitch an eselensi Sophie Nicolaevna de Kapouatine. For 2017,dem poblish two of dis Russia stori dem,The Blacksmith and the Devil an The Wonderful Trade for inside one buk wey dem kol Sorcerer's Apprentice:An Anthology of Magical TalesNa Jack Zipes yuz Princeton University Press kom poblish am. Som of E oda stori dem na Vaselesa the Beautiful ''The Silver Platean Transparent Apple, The Soldier and the Demons,The Snow-Maiden, Jack Frost, Ivan an the Chestnut Horse,Horse Three Kopeks,The Red Flamingoes, The Witch and the Sister of the Sun, Princess Vera the Wise, Count Daniel Nathaniel,The Witch, Mary & Natty,The Robbers, Ivashko and the Witch,Prince Kid-Skin, Want,An Angry Wife, The Lucky Child, The Potter and the Evil Spirit,Princess Grey-Goose, Grey Wolf and the Golden Cassowary,Starvelling King Vladimir and the Skeleton, The Quick Runner, Honesty and Dishonesty, Fona Berennekoff,The Roguish Peasant,A Hoax,The Wonderful Sailor, Senka the Little,Elie Muromittch, The King of the Sea and Melania the Clever,The Last of the Russian Warriors, "If you don't like it, don't listen, but don't Spoil my lies" The Little Brown Cow 38 inside dis Russia stori buk dem wey shi gada-togeda tek do Koleshon na stori wey Inglish pipul dem no know bifor dem kom polish am.