Edet Amana

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Chief Dr Edet Amana (dem bon am for December 11, 1938) na Naijá enjinia.

Tori of e laif an skul wey e go[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na December 11, 1938 dey bon Edet James Amana for Akwa Ibom Stet for Naijá. E go Methodist College, Uzuakoli an king's College, Lagos. E go Imperial College London (1961-1966) wey im get fest klass digree for Civil Engineering an na e bi ovarall best graduatin student. Edet wok for British Firm of Consulting Engineers. Wen e kom bak to Naijá e wok as Service Engineer for Shell-BP (1968-1972).

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Edet fom Amana Consulting Engineers in 1972. For Ova 15 years di kompini dey du di disign and implementation of projects of abaut $2bn. Di engineering services division held services for A.W. Chesterton of Boston, Mass and Hewlett Packard (1982). For 1981 dem kolabo with Earth Technology Corporation of California for geotechnical and geophysical surveying and mapping. Anoda venture wey involve Israeli cover architectural planning. Di kompini kolet 30 enjinias an 10 experts to wok for dem.Fom 1980, di grup bigin dey divelop robas farms and dey don establish one roba makin kompini. Di grup also dey into Insurance brokerage an tradin for di oil indostri. Dem stil get hand for banking, poblishin an propati. Edet Amana na di founding dareto of Citybank Nigeria Limited an im saf for di board of di Bank fom 1985-2010. Todey, Edet Amana na di Chairman of Amana Group of Company an na im bi di bifor bifor Presidor of di Nigerian Academy of Engineering. Im bi fellow of di Nigerian Society of Engineers, na im bi di forma Presidor of di Association of Consulting Engineers Nigeria, fellow Nigerian Institute of Management an fellow International Institute of Director. Im bi memba of American Society of Civil Engineers an di Association of African Development Experts.

Pasona laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Edet Amana fest waif na Mrs Doris Edet Amana an dem bon six pikin.Doris Edet dai for December 11,2004.E marri anoda waif wey bon two pikin for am an di waif nem na Lady Hilda Edet Amana.

Awords[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Officer of the Order of the Niger 2005
  • Knight of John Wesley awarded by Methodist Church Nigeria 2004
  • Doctor of Science DSc (Honoris Causa) by University of Uyo 2010

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]