Easter

From Wikipedia

Easter, wey dem dey also kol Resureshon Day and Pascha, na di kristen holide wey plenti pipul dey yuz tek selibrate Jesus Kraist returning fom di dead. Kristens bilive say dat na di day wey holi pass for di year. Som pipul wey nor bi kristens stil dey selibrate am as a kolshoral holide.

Easter nor dey hapun for di same date evri year. Som pipul don kol am moveable feast bikos di date dey chenj. Nau nau meni kristen chorches don gri on how dem tek dey kakulate di date. Dem dey selibrate Easter for di fest Sunday folowing di fest ful moon wen bi on or afta March 21st. Dis min say dem dey selibrate Easter for March or April. E fit hapun as earli as March 22 and as lait as April 25. Western chorches, like di Roman Katholik Chorch, dey yuz di Gregorian kalendar, while Eastern chorches, like di Eastern Orthodox Chorch, dey yuz di Julian kalendar. Bikos of dis, di date for Easter selibreshons dey difren for di two types of chorches, even doh di way dem tek dey kakulate Easter dey similar. For 2015, pipul evriwie bin selibrate Easter for April 5 for bot di Gregorian kalendar and Julian kalendar. For 2019, dem selibrate Easter for April 21.

For Easter Sunday, 9 April 2023, a Naija relijos figor Isaiah Ogedegbe bin kol on kristens all ova di world to imitate Kraist "by loving demselves genuineli".[1] [2][3]

Wie dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

  1. Ogedegbe, Isaiah (9 April 2023). "Easter: Christ Loved Us And Died For Us But Today Many Christians Don't Love Themselves". Opinion Nigeria. Archived from the original on 9 April 2023. Retrieved 9 April 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  2. Imoh, Jennifer (9 April 2023). "Easter: Christ Loved Us And Died For Us But Today Many Christians Don't Love Themselves". BreakingNews Nigeria. Archived from the original on 9 April 2023. Retrieved 16 April 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)
  3. "Easter: Christ Loved Us And Died For Us But Today Many Christians Don't Love Themselves". LifeStyle.com.ng. 9 April 2023. Archived from the original on 9 April 2023. Retrieved 16 April 2023.{{cite web}}: CS1 maint: bot: original URL status unknown (link)