Douye Diri

From Wikipedia

Douye Diri (dem bon am on 4 June 1959) na Naija politishan wey don sarf as govnor of Bayelsa Stet sins 2020. Na im bi di senator wey stand for Bayelsa Central Senatorial District fom 2019 rish 2020 insaid di 9th Nashonal Assembly.

How e tek stat life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Douye Diri stat im primari edukashon for Okoro Primary School, Sampou, an kon finish for Rev Proctor Memorial Primary School, Kaiama, in 1977, wia e tek kolet im Fest Skul Leaving Certifikate. E kon leta go Government Sekondri Skul, Odi wey dey Bayelsa. Douye go College of Edukashon, Port Harcourt, Rivers State, wia e get Nashonal Certificate in Edukashon (NCE) in 1985. E stil go Universiti of Port-Harcourt, wia e tek get Bachelor of Edukashon Digre insaid politika science in 1990.

Govnor of Bayelsa Stet[chenj-am | chenj-am for orijin]

On 13 February 2020, di Supreme Kourt of Nigeria kansu di resot of 2019 Bayelsa Stet gubernatorial eleshon bikos pesin wey win, David Lyon, sobmit wetin e no sopos sobmit for Independent National Electoral Commission (INEC). Di Kourt kon tok sey mek dem giv Diri certifikate of return, wey go mek am bi Di govnor wey dem vote for. On 14 February 2020, dem swear am in as di govnor of Bayelsa Stet.

August 2020 kourt mata[chenj-am | chenj-am for orijin]

On August 17 2020, one tribunal for Abuja anous sey mek dem sak Diri as govnor of Bayelsa Stet, leta on 2 October 2020, kourt of appeal wey sit for Abuja kansu di sak an komfam sey na Diri bi di govnor of Bayelsa Stet.

Wia dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1. Breaking Douye Diri Sworn in as Governor of Bayelsa. 14 February 2020. Retrieved 22 December 2023.

2. "Tribunal Sack Govnor Diri, Order fresh election just days after im bin jubilate sey e win case for di same court". BBC News Pidgin. 17 August 2020. Retrieved 23 December 2023.