Dancing England

From Wikipedia

Dancing England na bifor bifor tradishonal dans kompetishon wey pipo dey do for "Derby Assembly Room." Di kompetishon start from 1979 an e stop in 1987. Na Phil Heaton an John Shaw form di kompetishon. Di two of dem na memba of di Black cap Sword Dancers. Phil Heaton an John Shaw stil be popula pesin on di "Nottingham and Derby folk" an dans show wey dey hapun in 1970s

Dem form Dancing England bikos dem wan mek pipo kom see di best of tradishonal dans wey de UK. Di show stil dey selibrate di tradishonal kostom an kolsho of UK pipo

Di tori of Dancing England[chenj-am | chenj-am for orijin]

For 1979, Phil an John of Black cap agree sey dem go do one parti an kol all di best dansa wey de UK to join dem. Na dis idiya bring Dancing England kom.

Na wen sun don shine finish di Dancing England dey start. Meni tim wey sabi tradishonal dans wel wel wey de UK go dey paform one afta di orda. Ezampul of tim wey de dans for di kompetishon na Cotsworld Morris, Rapper Sword, Longsword, North West, step clog dancing, Border, Molly an meni meni ordas. Mummers an Pace Eggers , muzishan an oda pipo wey get difren talet sef fit parform. Tims like: "The Britannia Coconut Dancers", "Abbots Bromley Horn Dancers", an di "Whittlesey Straw Bear. " For di ples wey di parti deu hapun, Pipo fit sell dia muzik keset, fims, an dia hanwork.