Dahomey Amazon

From Wikipedia
Di Dahomey Amazon group araund 1890

Dahomey Amazon (wey Fon langwej pipo dey kol Agojie, Agoji, Mino, or Minon) na one Fon fimale group of soja wey kom from Kindom of Dahomey.(Di niu nem wey Kindom of Dahomey dey ansa todey na Benin. Benin de West Afrika. Dis Dahomey Amazon fimale soja dey hot wel wel in di 17 senturi to 19 senturi. Na dem bi di onli hami soja wey bi wuman for modern histri.

Na di westa Oyinbo pipo give dem di nem Dahomey Amazon wen dey mit dem akordin to one Greek tradishonal tori.

Di group kom abaut in Dahomey bikos fight-fight wey dey hapun bitwin Dahomey Kindom an oda kontri wey dey West Afrika don ova kill men-dem wey for bi soja to fit defen di kontri. Bikos Oyo Empiya no dis dia kondishon, dem kom stat to dey kari di pipo of Dahomey as slave an dey sell-dem for oyinbo pipo. For dat time, oyinbo pipo dey buy slave an es-chenj dem with difren kind of tins wey dey like. Di king of Dahomey no get oda way dan to jos stat dey pik wuman to join di soja.

How di group tek stat[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na king Houegbadja (wey Kontro Dahomey from 1645 go rish 1685) stat dis group. King Houegbadja bi di nomba three king to Kontro Dahomey from di histri of di empiya. In dia langwej dat time, na one group kol gbeto wey leta bikom Mino stat di soja group.Some tori tok sey di group don dey tey-tey bifor king Houegbadja bikom king an oda tori stil tok sey na di group go mit di king diasef to tel am sey dem wan fight for dia kontri.

King Houegbadja fimale-pikin wey leta bikom kween Hangbe ( e kontro Dahomey Kindom from 1716 go rish 1718) dey yuz onli wuman as e bodi-guard. Akordin to tori wey de, Queen Hangbe broda an di nes king wey kontro Dahomey afta di kween time don ova yuz dis wuman-dem soja tek difens di kingdom