Dagrin

From Wikipedia

Dem bon Oladapo Olaitan Olaonipekun wey plenti no as Dagrin foh (25 October 1984 - 22 April 2010), he kom from Ogun stet for Nigeria. Na rapa for Nigeria, Dem rilis one fim wey tok about e life wey dem kol Ghetto Dreamz foh 2011.

Early Laif[chenj-am | chenj-am for orijin]

Olaonipekun house dey foh Meiran, Alagbado, foh Ogun Stet.

Karia[chenj-am | chenj-am for orijin]

E rilis his fest audio albom wey bi Still on the matter. Foh 2009, e rilis his sekond studio albom wey e kol C.E.O. (Chief Executive Omoita). Foh 2010, dem nominet am foh di Nigerian Entertainment Awards for Best Album wey bi (C.E.O.), Hottest Single "Pon Pon Pon", Best Rap Act and Best Collaboration with vocals. E albom wey bi C.E.O (Chief executive Omota foh English: Chief Executive Thug) win di Hip hop World Award foh 2010 for best rap albom. Na from di albom im song wey bi "Pon Pon Pon", and "Kondo" dey. E wok wit som oda Naija atist dem like {Y.Q, 9ice, M.I, Iceberg Slim, Omobaba, Terry G, Ms Chief, Owen G, K01, code, MISTAR DOLLAR, TMD entertainment, Omawumi, Chudy K, Bigiano, and Konga}. Dem rilis e tord studio albom wey bi "If I Die" afta e don dai.

Im musik style[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dagrin dey among di fest set of pipul wey yus Yoruba and pidjin languej tek rap among Naija singa dem. One jonalis wey bi tori pesin foh "Premium Times" Idoko Salihu tok sey as Dagrin dey yus English wit e netiv languej to rap kom mek am transform di Nigeria rap indostri.

Ghetto Dreamz[chenj-am | chenj-am for orijin]

Ghetto Dreamz, na fim about e laif wey bi sey na Trybson Dudukoko and Doris Simeon wey bi Ademinokan akt as e girlfriend and Dem rilis di fim foh April 2011.

Albom wey e do Dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

  • Still On The Matter (2006)
  • If I Die (2011)C.E.O (Chief Executive Omoita) (2009)
  • If I Die (2011)

Awod and nomineshon dem[chenj-am | chenj-am for orijin]

E win di awod;

  • 2010 Hip Hop World Awards – Best Rap Album

E Death[chenj-am | chenj-am for orijin]

Olaonipekun get accident foh April 14, 2010 & e dai afta 8 days, foh 22 April, 2010 dat time e dey di age of 25 yehs wen e get di accident wit moto foh Legos, Nigeria.

Wie Dem Gada di Tori[chenj-am | chenj-am for orijin]