Cyril Stober

From Wikipedia

Cyril Stober na one Jonalist an pesin wey dey tok nuz for Naija. Dem bon am for Niger Stet. E go Fatima Secondary Secondary wey dem dey kol Father O'Connell Science College Minna.

How e tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Stober yuz ova 30 years of e karia tek wok as Jonalist an pesin wey de tok nuz. E mejo wok na di 9pm niuz for NTA netwok. Stober speshal dres wey bi lokal klot, kap an eye glas dem tek sabi am. E get one rumo wey tok sey im don retire, but e suprize pipul as dem see am for nuz again for April 21 2019, Stober ritaya from Nigerian Broadcasting Authority. Cyril Stober stil dey do regula program for NTA netwok afta im retirement as e don bekom big pesin for Naija.

Im Pasona Life[chenj-am | chenj-am for orijin]

Stober mari Efun Merriman-John, wey bi bifo bifo tok-tok pesin for nuz mata wey wok for Nigerian Télévision Authority ontil di time wey dem divos. For January 13 2019, Stober mari Elizabeth Banu for her taun wey bi Garkida, Adamawa state, Naija. E get three pikin-dem (two girl an one boy) from im mariage wit Efun Merriman -Johnson. Im new wife na tok-tok pesin for NTA, wey bi anoda brokasta for Nigeria Television Authority, for Abuja.

Where dem gada di tori[chenj-am | chenj-am for orijin]