Cynthia Morgan

From Wikipedia

Cynthia Ikponmwenosa Morgan (dem bon an on 23 September 1991), wey plenti pipu sabi as Cynthia Morgan, nau Madrina na Naija pesin wey sabi sing an rait song. Di Kain musik wey Shi dey du na pop, hip pop, danshol an rap. Plenti pipu sabi am wit two song wey shi rilis "Don't Break My Heart" an "Lead Me On", wey dem pley wel wel for redio an televishon. Cynthia fest akt fim in 2016 Bollywood muvie "The Wrong Number" wey Saint Joseph Ovenshi dairet an AY's komedy muvie A trip to Jamaica.

How shi tek stat life an skol[chenj-am | chenj-am for orijin]

Dem bon Cynthia Morgan for Benin City, Edo Stet wey shi tek go skol. Wen shi dey 3 years old, shi don dey folo im mama sing. Na onli Cynthia Morgan mama train am bikos dia papa komot for haus wen shi dey smol.

How shi tek wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Morgan stat to dey rait song Wen Shi dey 17 years old. Shi du rekod im fest rekod wit General Pype "Dutty Stepping". In 2008, Shi muv go Lagos bikos of im musik wok. Shi kol hasef "Killa Marshal" on stej. On 22 May 2020,. Cynthia Morgan sign rekod labl kontrat wit Jude 'Engees' Okoye's Northside Entertainment Inc. Afta som months, shi rilis two beta singu wey bi "Don't Break an "Lead me on" wey pipu lik wel.wel; wey mek Morgan dey insaid pesin wey fit win "Best Reggae/Dancehall Single" for Headies Award 2014. On May 23 2020, Cynthia Morgan wey neva rilis song for plenti years anous sey Shi don lus im stej nem, Cynthia Morgan, im VEVO akount, Instagram akount an som oda tins bikos of di kontrat wey e sign wit Jude Okoye. Shi tel pipu sey shi dey tink afta I'm kontrat wit Jude Okoye no go wel. Plenti pipu wey lik am kon give am moni for insaid GoFundMe akount wey dem opun for am.

Som of im wok[chenj-am | chenj-am for orijin]

Som Singles

"Dutty Stepping" (2009)

"Jhybo ft Cynthia Morgan-E jo lefero (2009)

"Right Move" (2011)

"High High High" & "Ojoro" (2012)

"Don't Break My Heart" & "Lead Me On" (2014)

"I'm Taken" (2014)

"Popori" (2014)

"German Juice" (2015)

"Come and Do" (2015)

"Simati Niya" (2015)

"Baby Mama (2015)

"Olowo" (2016)

"Bubble bup" (2016)

"In Love" (2017)

"No camera's" (2017)

"Summer Time" (2017)

"Hustle" (2020)

Madrina "Billion Dollar Woman" (2018)

"Lion" (2018)

Song wey shi du wit odas

Ejo le fe ro" – Jhybo ft. Cynthia Morgan (2010)

"Bruce Lee" – TK Tycoon ft. Cynthia Morgan & Tipsy (2011)

"Gbogbo Hustling" – Tha Suspect ft. Zee, Bigmaxx, Cynthia Morgan & Tesh Carter (2012) "Faaji" – Tony Ross ft. Cynthia Morgan & A-Q (2013)

"Money" – KKTBM ft. Yung6ix, Cynthia Morgan, Tesh Carter & SD (2014)

Give Dem" – DJ Prince ft. Dammy Krane, Mac 2 & Cynthia Morgan (2014)

"Shoki [Female Version]" – Lil Kesh ft. Chidinma, Eva & Cynthia Morgan (2014)

"Jamo" – Illbliss ft. Cynthia Morgan (2014) "Number 1" – Chopstix ft. Cynthia Morgan, Shaydee & Yung L (2015)

"Go Gaga (Remix)" – MC Galaxy ft. Stone Bwoy, Cynthia Morgan (2015)

"Telephone Lies" – Spydaman ft. Cynthia Morgan (2015)

"Come Over" – Splash ft Cynthia Morgan (2016)

"Twerk It" – Tony Ross ft. Cynthia Morgan, Phyno (2016)

"Fine n Clean" – Jesse Jagz ft. Cynthia Morgan (2017)

"Mosa" – Tony Ross ft Cynthia Morgan (2018)

Wia dey gadadi tori[chenj-am | chenj-am for orijin]

1.Cynthia Morgan reavels battle with depression what Jude Okoyedid to her. 24 May 2020, Daily Post Newspaper