Concealed Shoe

From Wikipedia

Meni Concealed Shoes na im pipo don found an bring komot from windo, floor, an seelin of buidin in oyinbo kontri (Europe). Pipo stil also see am for plenti ples around di wold.

Na dat time wey oyinbo kontri eyes neva too opun wey bi "early modern period" na im dem dey see dis kind concealed shoes. Brian Hoggard wey bi risasha tok sey, meni aria of a buidin wey dis concealed shoes de ( inside door, seelin, windo, ontop house) show sey some pipo bilif sey dis tin get pawa. E tok sey some pipo bilif sey dis tin fit protet pipo wey de inside di buidin from bad tins. Di bad tins wey dem bilif sey concealed shoe fit protet dem from na demon, ghost, an witch.

Oda pipo dey put am for dia house bikos dem bilif sey e fit bring belle kom wuman wey dey find pikin bifor. Odas dey do am bikos dem bilif sey na sakrifahi to juju of di house. [03-29, 15:39] Mon Pefi: Pipo don found Concealed shoes in difren kind of buidin like poblik buidin, vilej house, farm house, house wey pasto dey live an one Baptist chorch.

One Concealed shoes wey don old pass wey pipo don see na for Winchester Cathedral. Na for 1308 dey build di chorch an for na wie singa for chorch dey sit-down dey found am. Northampton Museum get one ples wey concealed shoes de. In 2012, dat aria don get 1900 diskova of di shoe. Na for Britan dem tek see half of di concealed shoes. Plenti of am kom from 19 senturi. Meni of di concealed shoe don tiya finish but dem don ripiya dem. Na one-one leg of di shoe plenti pass. Wen we divide all di concealed shoes wey dem don diskova, half of dem na smol pikin dem.

By di time wey 20 senturi wan start, meni pipo no dey pratis concealed shoes kostom again.