Computer Village

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Computer Village na one information and Communications Technology (ICT)accessories market wey im location dey for one community wey dem call Otigba for inside Ikeja di capital of Lagos state Southwestern Nigeria. Di market na im be di largest ICT accessory market for Africa. Computer village na perfect competition market under di umbrella of di computer and Allied products Dealers Association of Nigeria (CAPDAN). Apart say computer village dey sell information and Technology accessory di market also dey deal on repair of mobile phone and computers. Di computer and phone repairs fit either dey on software or hardware components depending on di nature of di faulty. Di market and di wide range of business activities give opportunities to computer engineers and technicians wey specialize for dem. Di market open everyday except for Sunday and public holidays. Dis daily business transactions and popularity don attract new investors and ICT dealers across Africa whereby e expand di market size and population with profound effects for Lagos state economy. Di ICT accessory market wey formerly dey for Ogunlana Drive surulere for early 1990s and di current location na mere residential area and offices. Recently Lagos state Government plan say dem go relocate over 3000 traders.

How dem take position Computer Village[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di market na perfect market wey be say no dealer get right to change di price of di product wey im dey sell or buy for inside di market. Di market get large number of buyers and sellers couple with large number of consumers wey ready to buy di product for certain price with respect to dia need and income. Di market no get Barriers to entry and exits from di market, dey permit long-term adjustment to changing for di market conditions. ICT dealers and consumers get di perfect knowledge of price,quality of di products and utility with zero incur cost for course of dia transactions. Di market also permit buyers make dem do rational purchases for di basis of information and price knowledge.

Di complain we follow Computer Village[chenj-am | chenj-am for orijin]

Certain activities for di market wey no good or wey dey effect di progress of di market dis one make some number of good pipu across di country dey complain about am. some of dis pipu don painfully experience di loss of money and prize gadgets to di scheme of unqualified engineers and fraudsters wey dey use chaotic market as medium to rip off pipu or sell fake product and services like mobile phones, software, accessories etc.Di market get plenty stories about stolen phones wey be say finally dem go go see am for computer village for unregistered trader and retailers too. some of di transaction dey take place inside motor, walkway and display units instead of a proper brick and morter store. However dem get two major categories of traders for di market di registered and di unregistered or free traders wey dey sell for nomadic and uncountable fashion Do later category of readers na dem dey easily dey perpetrate di crime for do Market give dia drifting liberties OK now mechanism dey establish toward against dis unauthorized dealers, sellers and fixers.