Climate change in Africa

From Wikipedia
Climate change in Africa
climate change by country or territory
Facet ofAfrica Chenj-am
ContinentAfrica Chenj-am

Klimet chenj in Afrika na big wahala for Afrika bikos Afrika kontinet dey among di kontinet wey dey sofa di hafet of klimet chenj wel wel. Infat, some risach buk tok sey na Afrika kontinet go sofa di hafet of klimet chenj pass oda kontinet for di wold. Dis sofa go hapun bikos Afrika no get mentod to kope with klimet chenj, dey dipen on dia nashora envaromet to fit live, an dia way of dorin agrikolsho na old mentod. Di wahala wey klimet chenj go korse to agrikolsho, to fud, to wota, an to di way hanima an plant dey tek dey helep diasef go plenti no bi smol. Dis one fit mek am veri difikot for Afrika to divelop kwik-kwik.

For 2007, IPCC tok with ful konfidens sey klimet chenj go hafet agrikolsho prodoshon an how fud go plenti rish in Afrika kontri. To manej dis klimet chenj, Afrika kontris go nid to ridus klimet chenj or find way to hajos to klimet chenj. Ova di komin years, klimet chenj go mek di wold hot pass bifor an dis one go mek plenti rain to fall. As tins dey now, Afrika don dey hot pass oda kontinet of di wold. Meni pat of Afrika fit no dey Ok for pipul to live inside bikos of dis klimet chenj, an dis go hafet human health, fud an povati. Di way rain go dey fall from one ples to anoda go dey difren but wetin dey suo bi sey rain no go bi like bifor again bikos of klimet chenj.

Afrika tempurashon don go up by 1% (pacent) sins di late 19th sentuari to di heli 21st sentuari an for sahel rijion, di tempurashon don go 3% (pacent) dorin di dry sisin. For ezampul, Kenya dey sofa for wetin klimet chenj dey do. Klimet chenj dey mek wota ful evriwie an som ples mek wota no de at all. Pipul wey dey tok wetin fit hapun for fushor tok sey dis two tins go dey bad more in di fushor. Oda pipul tok sey tok sey di tempurashon go go up bitwin 0.5% to 2%. For Nairobi wey bi big siti for Kenya, klimate chenj go mek Ghetto aria plenti. Livin in Ghetto aria dey korse dey kreate e own smol klimet bikos of di tins wey pipul dey yuz do house, di wey di house tek klose so tey breeze no dey flo norma, an di way eletrisiti an oda tins no dey di aria.

If we wan helep mek dis aria fit kope with Klimet chenj, dos house sopos to dey ok, an di aria sopos to fit kope with klimate chenj. Bikos pipul wan kope with dis klimate chenj, meni tins don dey go on. Some of di tins bi: SADC "Policy Paper Climate Change", an "adaptation strategy for the water cycle". Odas tins bi sey, pipul don join bodi to fit see mentod to kope with klimet chenj. Some of di progam wey pipul dey join hand for na

  • Programme on Climate Change Adaptation
  • Mitigation in Eastern and Southern Africa (COMESA-SADC).

Afrika Union wey bi intanashonal hoganazashon an wey get 55 kontri inside dem put down dia 47 plan in di year 2014 ripot on how to fight an hajos to klimet chenj. Di Sekretiri Jeneral of di United Nashon tok sey dey nid to join bodi with Afrika Union to fight klimet chenj in orda to mit dia UN Sustainable development goals. Di United Nashon guess sey with di way Afrika populashon dey gro, di kontinet nid $1.3 trillion dolla to fit kari out di Sustainable development goals evri year. Anoda hoganazashon Di Intanashonal Monitiri Fund guess sey Afrika nid $50 billion to fit kope with klimet chenj.