Climate change adaptation

From Wikipedia
Climate change adaptation
Subclass ofprocess, adaptation, politics of climate change Chenj-am
Facet ofglobal warming, climatic adaptation Chenj-am

Klimet chenj hajosmet na di way to hajos to wetin dey or wetin fit hapun bikos of klimet chenj. For human-bi, hajosmet to klimet chenj mins to lowa or kip away from wetin klimet chenj fit korse. Di tin stil inklud how human-bi fit find oda hopotuniti to hep nashora sistem. Wetin human-bi dey du for klimet chenj fit bi wetin dem dey du to mainten di nashora sistem or wetin dem du to hep nashora sistem bikos of klimet chenj.

Wetin human-bi nid to du bikos of klimet chenj difren from one aria to anoda. Dis tin dipen on how wetin dey wan du fit hafet odas human-bi wey dey di aria an how wetin dey wan du fit hafet plant an hanima wey dey di ples. Na four katigori we fit put all di wok wey we dey du to hajos to klimet chenj. Dem bi:

  1. to dey yuz instrumet an teknoloji fight klimet chenj
  2. to dey yuz hoganazeshon fight klimet chenj
  3. to dey yuz how human-bi dey du tins an di kolsho of human-bi fight klimet chenj
  4. to dey yuz nashoral tins araund us fight klimet chenj.

Na Divelopin kontris like Naijiria dey always sofa di hafet of klimet chenj. Di way human-bi fit hajos to klimet chenj no bi di sem mentod among difren aria an difren populeshon an pipul wey dey stey for divelopin kontris no too get di pawa to hajos to am. To hajos to klimet chenj beta, pesin nid mek di kommuniti wey e de gud an ondastand wetin dey go on an mek ekonomik of di aria beta wel wel to fit sopot how e wan tek hajos to klimet chenj.

Di tin bi sey, di more divelop a kontri bi, di more e go fit hajos to klimet chenj wey dey hapun. Somtimes, som pipul wey de som divelop kontri sef fit get som kind karatas wey fit mek am difikut for dem to fit hajos to klimet chenj. Even som divelop kontri stil fit find am difikut to hajos to niu tins wey klimet chenj dey korse wey dey neva si bifor in dia kontri.

Di moni wey dey go for hajosmet to klimet chenj no bi smol. E dey rish billion of dolla evri year for di nes years to kom.