Climate Change and fisheries

From Wikipedia

Di way klimet or weyda dey chenj enihow dey hafet fish in meni aria: If Ocean wota hot smol pass as e sopos bi, e go hafet all di fish-dem wey de inside di wota an di plant inside am. If di acid levu wey wota sopos get chenj, e go hafet livin tins inside di wota. Klimet chenj dey hafet di way wota dey flow an e dey mek wie pipul fit find fish we hard. Klimet chenj dey hafet difren fish in difren way. Klimet chenj dey mek wey we fit find fish inside wota dey chenj an how fish dey produs pikin inside wota. In fact, di way klimet dey chenj go soon hafet how meni fish de inside wota an how fish bizness go bi. Kontri wey bi sey na onli fish bizness dey tek dey chop go find am veri hard to live. Di nomba of fish wey kontri wey dia weyda dey hot like South Pacific rijion go fit katch go dey low bikos of klimet chenj.

Klimet chenj go hafet fish bizness an eni bizness wey na wota hanima bi di tin wey dem dey sell. Dis one go hard komuniti wey put hope on dis bizness to live. Big wota like sea or Ocean dey hep mek carbon (smoke wey dey kom from fiya) no too plenti as dem dey hol-am mek e no too plenti for di wold, but klimet chenj dey mek am hard for di sea to du am nowadaz. Klimet chenj don mek di way rain dey fall dey chenj an dis one dey hafet wota wey de side riva an inside fish pond-dem. Di wey evriwie de ova hot don mek di wota levu ova go up an dis one don mek flood de hapun, disis don plenti an weed full evriwie. Dis one fit korse mek buildin skata an mek prodoshon ridus wel wel.