Chronicles from the Land of the Happiest People on Earth

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Chronicles from the Land of the Happiest People on Earth na one buk or novel wey Naija raita Wole Soyinka rait for 2021.Di novel na e nomba 3 novel.Di last time wey Wole Soyinka rait novel bifor dis one na in 1973 wen e rait Season of Anomy.

Wetin dey inside di buk[chenj-am | chenj-am for orijin]

Di buk tok abaut Naija, bot Wole Soyinka rait am as if e jus tink am.For di buk, one sikret Sosaeti dey wey bi ogas for rilijion an politis dey yuz human pat as sakrifas.Di oga-dem dey get di human bodi from Dr.Menka hospitu an na tif dem dey tif di human bodi.Dr.Menka get one frend wey e nem Duyole an Duyole wan go stat niu job for United Nation an di wok dey New York City. E get som juju pawa wey no like mek Duyole go du di wok an dey kom dey distop am so dat e no go fit go du di wok.Dem yuz di tori tek tok abaut di bad-bins wey dey hapun inside gofment wok for Naija and som kontri-dem for Afrika in a metod wey no dey daret so dat meni pipul no go no sey na dem di buk dey tok abaut.

Wetin dey tok about di buk[chenj-am | chenj-am for orijin]

Meni pipul wey tok abaut buk tok fine -fine tins abaut dis Wole Soyinka Novel.Ben Okri, wey bi Naija raita tok abaut di buk inside The Guardian.E tok dey di buk na " a vast dense Macabre" an e stil tok sey na dis buk gud pass for all di wok wey Wole Soyinka don rait.Ben Okri tok sey di buk na Wole Soyinka rivenji against di pipul wey dey rul in bad way in di kontri an for meni Afrika kontris in di 21st Senturi.The New York Times to dey Wole Soyinka rait di buk bikos of e pain wey e dey feel for e kontri Naija. NPR no too tok gud tins abaut di buk an sey di buk no dey among Wole Soyinka best buk. NPR tok sey di buk get som pat wey rili gud an dey di buk mek you no how life bi for Naija.