Chidinma Aaron

From Wikipedia
Jump to navigation Jump to search

Chidinma Leilani Aaron (Dem bon am for April 16, 1993) na Naijá model, bizness wuman, e dey mek food for pipul, e dey hep pipul gro día bizness an e dey gif pipul beta-beta advais.

How e Tek stat life an skul wey e go[chenj-am | chenj-am for orijin]

Na for Kaduna in Kaduna Stet dey Tek bon Chidinma bot na for Abuja wey bi Kapital of Naijá e Tek gro up.Chidima get two sista an one broda. Chidima go Ibadan wey dey Oyo Stet so fat e go fit go Lead City University to get Bachelor of sayens degri for Business Administration for 2017. Bifor Chidima win Miss Naijiria, e don wok as pesin wey dey mek food an pesin wet dey tok to kustoma to no wetin dey nid for Yumme meal, one fud kompini wey dey Abuja.